YouVersion Logo
Search Icon

1 Korintians 9

9
Di Apostles Pawa
1I nor dey free? I nor bi apostle? Abi I neva si awa Oga God Jesus? Nor bi una dey show di work wey I don do? 2If I nor bi apostle to oda pipol, at least I bi apostle to una, bikos na una bi di sign wey show sey I bi Jesus Christ apostle. 3Wen pipol ask mi kweshon, I dey tell dem sey, 4mi and Banabas fit chop and drink wetin wi like, 5abi wi nor get rite to marry biliver for Christ? 6Na only wi must work before wi go chop? 7E get any soja wey dey pay ensef salari? Abi who plant vegitabol, nor dey chop for inside? Or who dey keep sheep nor dey drink from dia milk? 8Una tink sey na only kommon sense I take dey tok all dis tins? Abi una don forget sey di law tok like dis too? 9Moses sey, “Make una allow animal wey grind korn chop from wetin e dey grind.” So, una tink sey na di melu God dey worry for? 10No! Na wi God dey tok about. Dem rite all dis tins for di law, so dat evribody wey work, go fit chop for harvest time. 11So if wi don plant spiritual seed among una, e go dey too mush if wi ask for ordinary food and drink from una?
12If odas dey do like dis, dat mean sey wi even get betta rite to do like dat too. But, wi dey bear evritin, so dat wi nor go kause trobol for Christ message. 13Una nor know sey doz wey dey work for di temple dey chop food wey pipol bring kon give God for der? Abi una nor know sey pesin wey dey serve for altar na from der e for dey chop? 14Na so too God kommand sey, doz wey dey prish di gospel, go chop thru di gospel wey dem dey prish. 15But I nor dey use all dis rite and I nor dey rite dis tins so dat pesin go give mi sometin. E betta make I die, dan make anybody kon make mi stop to dey tok like dis. 16Bikos if I dey prish di gospel, I nor get any rizin to boast, bikos I nor fit do any oda tin dan to dey prish di gospel! Na wahala for mi, if I nor prish di gospel! 17If I prish bikos I wont prish, dem go pay mi, but even if I nor wont prish, di prishin na wetin God send mi kom do. 18Wetin kon bi my gain? Na to prish di gospel without pay or na to use di rite wey I get, bikos I dey prish di gospel?
19I nor bi anybody savant. But I don turn savant to evribody, so dat I go fit win many pipol for Christ. 20Wen I dey with Jew pipol, I dey live like dem, so dat I go win dem for Christ. Na Moses Law dem dey follow, but I nor dey follow dat one. But I dey live as di law tok, so dat I go win souls kom meet Christ. 21And wen I dey with pipol wey nor dey live by di law, I nor dey use di law for dem, so dat I go fit win dem. But dat nor mean sey, I go forget God law, bikos na Christ law dey rule mi. 22Wen I dey with pipol wey get weak faith, I dey live as dem dey live, so dat I go fit win dem. I dey do evritin wey I fit do, so dat I go fit win evribody wey I fit win, kom meet Christ.
23Na di gospel make mi dey do all dis tins, so dat I go fit share for di blessings.
24Una nor know sey, wen pipol dey run, na only one pesin go win di race and di prize? So make una run, so dat una go fit win! 25Pipol wey dey run, dey train well-well, so dat dem go win crown wey nor dey last, but wi dey run for crown wey go last forever.
26So I nor dey run for nor-tin and I nor dey follow breeze fight. 27Instead, I dey kontrol my body kon make am my slave, so dat afta I don prish di Good News give odas, God nor go rijet mi.

Currently Selected:

1 Korintians 9: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in