1
Titus 1:16
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Dis kind pipol dey sey dem know God, but di way wey dem dey live dia life, show sey dem nor know am, bikos dem get bad mind, dey disobey God and dem nor ever dey like betta tin.
Compare
Explore Titus 1:16
2
Titus 1:15
Evritin dey pure to doz wey dia heart dey pure. But nor-tin dey pure to doz wey bad tins full dia mind.
Explore Titus 1:15
3
Titus 1:9
E must bilive di message about God wey e dey tish, so dat e go fit tell pipol di trut and korrect doz wey dey oppoz am.
Explore Titus 1:9
4
Titus 1:7-8
Make pesin wey bi leader nor get fault, bikos na God work e dey do. Make e nor dey karry body up; dey kwik vex or drink anyhow; dey like to beat pipol or love money. Instead make e dey welkom strenjas for en house; love wetin dey good and e must get sense; make e nor dey put hand for bad tin; e must dey holy and fit kontrol ensef.
Explore Titus 1:7-8
5
Titus 1:6
Anybody wey won bi elder must dey good. E must get only one wife and en shidren must bi bilivers; dey gentol and dey respet demsef.
Explore Titus 1:6
Home
Bible
Plans
Videos