Titus 1
1
I Salot
1Na Paul, wey bi Jesus Christ apostle and God savant rite dis leta to help pipol wey God don choose, so dat dia faith go strong kon know di trut wey go help dem live di kind life wey God wont. 2Di trut dey give dem di mind sey dem get life wey nor dey end and na God wey nor fit lie promise dem dis life even before E kreate di world. 3As di time don rish, E don give us en message thru di word wey wi dey prish give evribody and na God awa Savior give mi pawa to do dis work. 4I dey rite to Titus, my own pikin for faith. Make grace and peace wey dey kom from God awa Papa and from awa Savior Jesus Christ, dey with yu.
Titus Work For Krete
5Titus! Na dis message make mi leave yu for Krete, so dat yu go kontinue awa work for der and pick new leaders for each town, just as I kommand yu. 6Anybody wey won bi elder must dey good. E must get only one wife and en shidren must bi bilivers; dey gentol and dey respet demsef. 7Make pesin wey bi leader nor get fault, bikos na God work e dey do. Make e nor dey karry body up; dey kwik vex or drink anyhow; dey like to beat pipol or love money. 8Instead make e dey welkom strenjas for en house; love wetin dey good and e must get sense; make e nor dey put hand for bad tin; e must dey holy and fit kontrol ensef. 9E must bilive di message about God wey e dey tish, so dat e go fit tell pipol di trut and korrect doz wey dey oppoz am.
10Many pipol nor won do wetin God tok, instead, dem dey tok anyhow, dey deceive pipol and follow Jew pipol law wey sey, evribody must sekonsaiz. 11So wi must stop dem, bikos dem dey tish pipol tins wey go make pipol komot from di trut and dem dey do like dis, bikos of di money wey dem go get. 12Even one among dia own profets sey, “Krete pipol dey always tok lie, dem bi wiked animals and lazy pipol wey get long-trot.” 13Wetin di profet tok, na true. So bikos of dis, make yu stop dem, so dat di bilivers go strong for faith. 14Make dem stop to listin to Jew pipol lie-lie story and nor dey bihave like doz wey nor bilive. 15Evritin dey pure to doz wey dia heart dey pure. But nor-tin dey pure to doz wey bad tins full dia mind. 16Dis kind pipol dey sey dem know God, but di way wey dem dey live dia life, show sey dem nor know am, bikos dem get bad mind, dey disobey God and dem nor ever dey like betta tin.
Currently Selected:
Titus 1: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee