1
Romans 6:23
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Bikos, di reward for sin, na deat, but God gift wey Jesus Christ dey give us, na life wey nor dey end.
Compare
Explore Romans 6:23
2
Romans 6:14
Sin nor go fit kontrol una, bikos una nor dey under di law again, but na God grace dey kontrol una naw.
Explore Romans 6:14
3
Romans 6:4
Dem beri us with am wen wi baptize, so as God raiz Christ from deat thru en pawa with glory, na so wi too go get life wey nor dey end.
Explore Romans 6:4
4
Romans 6:13
Make una nor let Satan use una body take do bad tins, but make una karry unasef give God as pipol wey don wake-up from deat, so dat una go dey do good tins.
Explore Romans 6:13
5
Romans 6:6
Wi know sey di pesin wey wi bi before, dem don nail am for cross with Jesus. So awa body nor bi sin savant again.
Explore Romans 6:6
6
Romans 6:11
So make una know sey, una don ovakom sin too and una get life thru Jesus Christ.
Explore Romans 6:11
7
Romans 6:1-2
So wetin wi go tok? Make wi kontinue to dey sin so dat God grace go dey with us? No! Why wi wey don turn from sin go still dey live inside am?
Explore Romans 6:1-2
8
Romans 6:16
Yu nor know sey wetin yu give yor body to, na-im go kontrol yu? If na sin, e go kause deat, but if na God, E go make yu dey live raitious life.
Explore Romans 6:16
9
Romans 6:17-18
But wi tank God sey, even doh una bi slave to sin before, una don use una heart dey obey all di tins wey wi dey tish una. And as e bi sey una don free from sin, una don bikom slave to good tins.
Explore Romans 6:17-18
Home
Bible
Plans
Videos