Romans 6
6
Life Inside Christ
1So wetin wi go tok? Make wi kontinue to dey sin so dat God grace go dey with us? 2No! Why wi wey don turn from sin go still dey live inside am? 3Abi una nor know sey all di pipol wey dem baptize inside Christ don die with am? 4Dem beri us with am wen wi baptize, so as God raiz Christ from deat thru en pawa with glory, na so wi too go get life wey nor dey end.
5Bikos if wi don die with Jesus Christ thru baptizim, God go raiz us up with am. 6Wi know sey di pesin wey wi bi before, dem don nail am for cross with Jesus. So awa body nor bi sin savant again. 7Bikos pesin wey don die, don free from sin.
8As wi die with Christ, wi bilive sey wi go live with am. 9Wi know sey since God don raiz Christ up, e nor go die and deat nor get pawa for en body again. 10Bikos as e die, e don ovakom sin forever, so di life wey e dey live naw, e dey live am for God. 11So make una know sey, una don ovakom sin too and una get life thru Jesus Christ.
12Derfor, make una nor allow sin kontrol una body again, so dat una nor go dey do bad tins. 13Make una nor let Satan use una body take do bad tins, but make una karry unasef give God as pipol wey don wake-up from deat, so dat una go dey do good tins. 14Sin nor go fit kontrol una, bikos una nor dey under di law again, but na God grace dey kontrol una naw.
Good Savant
15So na wetin wi go tok? Make wi still dey sin, bikos wi get God grace and wi nor dey under di law again? God forbid! 16Yu nor know sey wetin yu give yor body to, na-im go kontrol yu? If na sin, e go kause deat, but if na God, E go make yu dey live raitious life. 17But wi tank God sey, even doh una bi slave to sin before, una don use una heart dey obey all di tins wey wi dey tish una. 18And as e bi sey una don free from sin, una don bikom slave to good tins. 19(I dey tok with human being sense, bikos I know sey una dey weak.) Before, una dey give una body like slave to bad tins, but naw, una must use una full body take serve God, so dat una go dey do only wetin God wont. 20Bikos wen una bi sin savant, una nor nid to dey raitious.
21So wetin una gain from all doz bad tins wey una do? Na shame and deat doz tins dey bring. 22But naw, una don dey free from sin kon bi God savant. Dis go make una dey holy and God go give una life wey nor dey end. 23Bikos, di reward for sin, na deat, but God gift wey Jesus Christ dey give us, na life wey nor dey end.
Currently Selected:
Romans 6: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee