1
Romans 12:2
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Make una nor bi like pipol for di world, but make una allow God shange una mind, den una go know how to serve God and do tins wey dey make belle sweet am.
Compare
Explore Romans 12:2
2
Romans 12:1
My brodas and sistas, God dey good. So Abeg, as una dey alive, make una dey offa una body gi-am as sakrifice. Make una dey do wetin E tok and wetin go make belle sweet am. Na dis bi di best way to serve God.
Explore Romans 12:1
3
Romans 12:12
Make una let una hope give una happiness. Make una dey patient wen trobol kom and nor stop to pray.
Explore Romans 12:12
4
Romans 12:21
So, make una nor let bad tins kontrol una, but make una let di good tins wey una dey do, plenty pass wikedness.
Explore Romans 12:21
5
Romans 12:10
Make una love each oda like brodas and sistas and make una respet oda pipol pass unasef.
Explore Romans 12:10
6
Romans 12:9
Make wi love each oda well-well. Make una hate anytin wey dey bad, but una must love anytin wey get trut.
Explore Romans 12:9
7
Romans 12:18
and make una try to live for peace with evribody.
Explore Romans 12:18
8
Romans 12:19
Make una nor try to pay anybody for di bad tin wey dem do una, but make una leave am for God, bikos God word sey, “Na mi go revensh for una. I go pay dem back.”
Explore Romans 12:19
9
Romans 12:11
Make una nor taya, but with di Holy Spirit help, make una serve God with betta mind.
Explore Romans 12:11
10
Romans 12:3
By di grace wey God give mi, I dey tell all of una, make una nor tink sey una too dey important. Instead, make una use good sense tink and undastand di faith wey God give una.
Explore Romans 12:3
11
Romans 12:17
Make una nor pay evil for evil, but make sure sey wetin una dey do, good for God and pipol eye
Explore Romans 12:17
12
Romans 12:16
Make una try to bi friend with evribody. Make una nor karry body up kon feel sey una wise pass evribody, instead, make una dey make friend with doz wey nor dey important.
Explore Romans 12:16
13
Romans 12:20
God word still sey, “If yor enemy dey hongry, make yu gi-am food chop, if en troat dry, make yu gi-am wota drink, bikos as una dey do so, na wahala una dey karry put for en head.”
Explore Romans 12:20
14
Romans 12:14-15
Make una nor curse pipol wey dey opress una, but make una pray make God bless dem. Wen pipol dey happy, make una follow dem happy and wen dem dey kry, make una follow dem kry too.
Explore Romans 12:14-15
15
Romans 12:13
Make una give food to God pipol wey dey hongry and make una dey welkom dem for una house.
Explore Romans 12:13
16
Romans 12:4-5
Pesin body get difren parts and all di parts get dia own work. Na so e bi with us. Wi many, but wi bi difren parts for Christ body and wi bilong to each oda.
Explore Romans 12:4-5
Home
Bible
Plans
Videos