YouVersion Logo
Search Icon

Romans 12

12
New Life For Christ
1My brodas and sistas, God dey good. So Abeg, as una dey alive, make una dey offa una body gi-am as sakrifice. Make una dey do wetin E tok and wetin go make belle sweet am. Na dis bi di best way to serve God. 2Make una nor bi like pipol for di world, but make una allow God shange una mind, den una go know how to serve God and do tins wey dey make belle sweet am.
Respet
3By di grace wey God give mi, I dey tell all of una, make una nor tink sey una too dey important. Instead, make una use good sense tink and undastand di faith wey God give una. 4Pesin body get difren parts and all di parts get dia own work. 5Na so e bi with us. Wi many, but wi bi difren parts for Christ body and wi bilong to each oda. 6True God grace, E don give us difren-difren gift to use. If wi dey profesai, make wi do am akordin to di faith wey wi get. 7If wi dey serve odas, make wi serve dem well. If wi dey tish, make wi tish well. 8If wi dey prish, make wi prish well. If wi dey give, make wi do am with betta mind. If wi dey lead odas, make wi do awa best. If wi dey do good to odas, make wi do am with happiness.
Love
9Make wi love each oda well-well. Make una hate anytin wey dey bad, but una must love anytin wey get trut. 10Make una love each oda like brodas and sistas and make una respet oda pipol pass unasef. 11Make una nor taya, but with di Holy Spirit help, make una serve God with betta mind. 12Make una let una hope give una happiness. Make una dey patient wen trobol kom and nor stop to pray. 13Make una give food to God pipol wey dey hongry and make una dey welkom dem for una house. 14Make una nor curse pipol wey dey opress una, but make una pray make God bless dem. 15Wen pipol dey happy, make una follow dem happy and wen dem dey kry, make una follow dem kry too. 16Make una try to bi friend with evribody. Make una nor karry body up kon feel sey una wise pass evribody, instead, make una dey make friend with doz wey nor dey important. 17Make una nor pay evil for evil, but make sure sey wetin una dey do, good for God and pipol eye 18and make una try to live for peace with evribody. 19Make una nor try to pay anybody for di bad tin wey dem do una, but make una leave am for God, bikos God word sey, “Na mi go revensh for una. I go pay dem back.” 20God word still sey, “If yor enemy dey hongry, make yu gi-am food chop, if en troat dry, make yu gi-am wota drink, bikos as una dey do so, na wahala una dey karry put for en head.” 21So, make una nor let bad tins kontrol una, but make una let di good tins wey una dey do, plenty pass wikedness.

Currently Selected:

Romans 12: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in