Gentile pipol, una bi like branches wey dem add join olive tree. Una don take di place for some branches wey God first kut komot. So una dey enjoy di blessings, wey di rut dey give. So make una nor boast, but make una remember sey, nor bi una dey make di rut stand, but na di rut dey support una.