1
Psalms 1:1-2
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
God go bless di pesin wey nor dey follow wiked pipol advise, dey waka with sinnas or sidan with aproko pipol! Instead, e dey always dey happy to obey God kommand and na both for day and nite, e dey study dem.
Compare
Explore Psalms 1:1-2
2
Psalms 1:3
E bi like tree wey dem plant near wota; wey dey bear fruit for di korrect time and en leaf nor dey dry. E dey prosper for anytin wey e do.
Explore Psalms 1:3
3
Psalms 1:6
True-true, God dey guide en pipol for evritin wey dem dey do, but E go distroy doz wey nor dey follow en ways.
Explore Psalms 1:6