1
Proverbs 12:25
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
If pesin dey worry, e go make am sick, but betta word go make yor body strong again.
Compare
Explore Proverbs 12:25
2
Proverbs 12:1
Pesin wey dey happy wen dem korrect am, get wisdom, but anybody wey dey vex wen dem korrect am, nor get sense.
Explore Proverbs 12:1
3
Proverbs 12:18
Foolish pipol dey tok anyhow, but wetin wise pipol tok, dey heal many wound.
Explore Proverbs 12:18
4
Proverbs 12:15
Foolish pipol dey always tink sey wetin dem dey do dey korrect, but wise pipol dey listin to odas.
Explore Proverbs 12:15
5
Proverbs 12:16
Foolish pipol dey kwik vex, but wise men nor dey tok even wen dem curse dem.
Explore Proverbs 12:16
6
Proverbs 12:4
Good wife dey bring joy and pride to en husband; but wife wey dey bring shame for en husband bi like diziz for en bone.
Explore Proverbs 12:4
7
Proverbs 12:22
God hate pipol wey dey lie, but E like doz wey dey tok trut.
Explore Proverbs 12:22
8
Proverbs 12:26
Doz wey dey fear God dey advise dia friends well, but wiked pipol dey lead dem enter wahala.
Explore Proverbs 12:26
9
Proverbs 12:19
Trut go last forever, but lie-lie nor dey tey before evribody go know sey na lie.
Explore Proverbs 12:19
Home
Bible
Plans
Videos