1
Isaya 11:2-3
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
God Spirit go dey with am. E go gi-am di Spirit wey dey give wisdom; di Spirit wey dey give knowledge and di Spirit wey dey give good undastandin. E go still gi-am di Spirit wey dey give pawa and di Spirit wey go make am rule well. E go gi-am di Spirit wey go make am fear God and do wetin E wont. E go always dey happy to obey God. E nor go judge pipol anyhow or with wetin dem tell am.
Compare
Explore Isaya 11:2-3
2
Isaya 11:1
For dat time, one pesin go kom from Jesse family. Yes! One rut go grow kom out from David house.
Explore Isaya 11:1
3
Isaya 11:4
E go judge evribody akordin to wetin dem do kon defend doz wey nobody dey help. E go ponish wiked pipol and doz wey dey do bad tins, go die.
Explore Isaya 11:4
4
Isaya 11:5
E go rule en pipol with betta mind and respet.
Explore Isaya 11:5
5
Isaya 11:9
So, great Zion, God hill wey dey holy, no evil or wahala go dey der again. Just as wota dey full sea, na so too God word go full pipol heart for di land.
Explore Isaya 11:9
6
Isaya 11:6
Just as wolf and sheep wey nor dey gri but kon stay togeda for peace, na so too leopard go liedan with yong goat. Yong sheep and small lion go chop togeda and small pikin go dey kare for dem.
Explore Isaya 11:6
7
Isaya 11:10
Di day dey kom wen di new king from David family go bi sign to all di nashons. Pipol go gada for en royal town; gi-am respet kon ask make e guide dem.
Explore Isaya 11:10
Home
Bible
Plans
Videos