1
Hibru 9:28
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
na so too Christ die wons, as sakrifice to forgive pipol forever and naw, e go bring salvashon to doz wey dey wait for am.
Compare
Explore Hibru 9:28
2
Hibru 9:14
wot of Christ blood wey klean us from deat, so dat wi go fit woship God? Dis na di Christ wey offa ensef to God as di rite sakrifice for awa sins and e do am with di Holy Spirit pawa.
Explore Hibru 9:14
3
Hibru 9:27
Bikos God sey, na only wons man go die and afta dat, judgement go kom
Explore Hibru 9:27
4
Hibru 9:22
True-true, akordin to di law, na almost evritin blood dey make klean and if dem neva pour blood, God nor go forgive dem dia sins.
Explore Hibru 9:22
5
Hibru 9:15
Na dis make am bi middo-man for di new kovenant, so dat pipol wey e koll go fit receive di propaty wey go dey forever. E promise us dis propaty, wen e die to free us from di bad-bad tins wey wi don do wen di first kovenant still dey.
Explore Hibru 9:15
Home
Bible
Plans
Videos