1
Hibru 7:25
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
So, di pipol wey Jesus take go meet God, e go save dem for forever and ever, bikos e dey alive to pray for dem.
Compare
Explore Hibru 7:25
2
Hibru 7:26
Na Jesus bi di High Priest wey wi nid. E nor dey do bad tin; e dey holy; nor dey make mistake and e nor bi like wi, wey bi sinnas. God praiz am pass evritin wey dey heaven
Explore Hibru 7:26
3
Hibru 7:27
and e betta pass any oda high priests. Jesus nor nid to offa sakrifice evriday, like di oda priests wey dey offa for dia own sins and for di pipol own. Bikos na wons and for all e sakrifice ensef for evribody, wen e die for di cross.
Explore Hibru 7:27
Home
Bible
Plans
Videos