1
Galatians 5:22-23
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
But di fruit wey di Holy Spirit dey bear inside us; na love, joy, peace, patient, kindness, goodness, faithfulnes, gentolness and to kontrol awasef. Di law nor dey against all dis tins.
Compare
Explore Galatians 5:22-23
2
Galatians 5:16
I tell una, make una let di Spirit direct una life and una nor go do wetin di flesh wont.
Explore Galatians 5:16
3
Galatians 5:25
If di Holy Spirit dey inside us, den make wi dey live awa life as di Holy Spirit wont.
Explore Galatians 5:25
4
Galatians 5:24
Pipol wey dey inside Christ don kill dia flesh with all di bad tins wey di flesh dey like to do.
Explore Galatians 5:24
5
Galatians 5:19-21
Na di tins wey di flesh dey do bi dis: To sleep with pesin wey yu nor marry; to get bad mind; to opress pipol; to dey serve juju; dey do majik; kworel-kworel life; fighty-fighty; jealousy; anyhow vexnashon; long-trot; tins wey dey skata pipol; bad belle; killi-killi; to dey drink anyhow and dey do oda tins like all dis ones. I dey warn una naw as I don warn una before sey, pipol wey dey do dis kind tins, nor go enter God kingdom!
Explore Galatians 5:19-21
6
Galatians 5:13
My brodas and sistas, God don koll una make una dey free; but make una nor use di freedom wey God give una anyhow, instead make una love each oda.
Explore Galatians 5:13
7
Galatians 5:17
Bikos di tins wey di body like, difren from wetin di Spirit like and wetin di Spirit wont, nor dey gri with wetin di flesh wont.
Explore Galatians 5:17
8
Galatians 5:14
Bikos if dem add di whole law togeda, dem go kon bi one kommandment wey sey, “Make yu love yor neighbour as yu love yorsef.”
Explore Galatians 5:14
9
Galatians 5:26
Make wi nor dey karry body up and dey do wetin go vex pipol or dey jealous one anoda.
Explore Galatians 5:26
10
Galatians 5:1
Make una nor dey karry load for head like slave again, but make una stand strong for groun, bikos Christ don make us free.
Explore Galatians 5:1
Home
Bible
Plans
Videos