Galatians 5
5
Freedom Wey Bilivers Get
1Make una nor dey karry load for head like slave again, but make una stand strong for groun, bikos Christ don make us free. 2Una dey hear so! Mi wey bi Paul dey tell una sey, if dem sekonsaiz una, den Christ nor mean anytin to una again. 3And I dey warn evribody; anybody wey gri make dem sekonsaiz am, must obey evry oda tin wey di law tok. 4Pipol wey wont make pipol know sey dem dey good, bikos dem dey keep di law, dem don already fall komot from God grace. 5Bikos na thru faith for God Spirit, naim wi hope sey, God go make us dey good for en eye. 6For Christ, e nor matter weda dem sekonsaiz pesin or not; di only tin wey matter, na faith wey dey work thru love.
7Before, una dey do well; but naw, who sey make una nor obey di trut? 8Nor bi God wey koll una sey make una dey do like dis! 9Na small yist dey make bread raiz! 10I get mind sey, God nor go let una listin to anoda pesin. But di pesin wey dey konfuse una, go face judgement, no matter who e bi. 11Naw, my brodas and sistas, if I still dey prish about how dem go take sekonsaiz una, why pipol dey trobol mi? If na so, my tishing about Christ cross nor suppose kause any trobol. 12I wish sey doz wey dey disturb una go-go sekonsaiz demsef!
Paul Prish About Love
13My brodas and sistas, God don koll una make una dey free; but make una nor use di freedom wey God give una anyhow, instead make una love each oda. 14Bikos if dem add di whole law togeda, dem go kon bi one kommandment wey sey, “Make yu love yor neighbour as yu love yorsef.” 15But if una kontinue to kworel among unasef; una go fit wound or kill each oda by mistake. 16I tell una, make una let di Spirit direct una life and una nor go do wetin di flesh wont. 17Bikos di tins wey di body like, difren from wetin di Spirit like and wetin di Spirit wont, nor dey gri with wetin di flesh wont. 18But if una allow di Spirit kontrol una, den una nor dey under di law again. 19Na di tins wey di flesh dey do bi dis: To sleep with pesin wey yu nor marry; to get bad mind; to opress pipol; 20to dey serve juju; dey do majik; kworel-kworel life; fighty-fighty; jealousy; anyhow vexnashon; long-trot; tins wey dey skata pipol; 21bad belle; killi-killi; to dey drink anyhow and dey do oda tins like all dis ones. I dey warn una naw as I don warn una before sey, pipol wey dey do dis kind tins, nor go enter God kingdom!
22But di fruit wey di Holy Spirit dey bear inside us; na love, joy, peace, patient, kindness, goodness, faithfulnes, 23gentolness and to kontrol awasef. Di law nor dey against all dis tins. 24Pipol wey dey inside Christ don kill dia flesh with all di bad tins wey di flesh dey like to do. 25If di Holy Spirit dey inside us, den make wi dey live awa life as di Holy Spirit wont. 26Make wi nor dey karry body up and dey do wetin go vex pipol or dey jealous one anoda.
Currently Selected:
Galatians 5: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee