1
Efesians 6:12
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Bikos, wi nor dey fight against human being, but na against di wiked rulers wey dey for dis world, against evil spirits and pawas wey dey di heavens.
Compare
Explore Efesians 6:12
2
Efesians 6:18
With difren prayers, make una dey ask God to help una. Make una always dey pray with di Spirit and dey shine una eyes well-well. Make una nor give up, but make una kontinue to pray for all God pipol.
Explore Efesians 6:18
3
Efesians 6:11
Make una wear komplete soja uniform wey God dey give, so dat una go fit stand fight di wayo wey devil dey use.
Explore Efesians 6:11
4
Efesians 6:13
Na dis make mi sey, make una wear komplete soja uniform wey God dey give, so dat una go fit stand for groun wen trobol and wahala go kom and wen una don win, una go still stand well.
Explore Efesians 6:13
5
Efesians 6:16-17
and with all dis, make una karry faith wey go help una kwensh all di wiked arrows wey Satan dey trow. Make una wear salvashon like priest kap for head kon whole di Spirit swod wey bi God word.
Explore Efesians 6:16-17
6
Efesians 6:14-15
So, make una stand well-well kon tie trut like belt round una waist, den wear bullet proof koat as raitiousness for una body. Make una wear shoe for leg wey go show sey, una dey ready to prish di Good News wey dey give pipol peace
Explore Efesians 6:14-15
7
Efesians 6:10
Finally, make una dey strong with Christ mighty pawa.
Explore Efesians 6:10
8
Efesians 6:2-3
Make una respet una papa and mama, bikos na dis bi di first kommandment from God wey get promise. So dat e go betta for una and una go get long life.
Explore Efesians 6:2-3
9
Efesians 6:1
Shidren, as una know God, make una dey hear una papa and mama word, bikos na wetin una suppose do bi dat.
Explore Efesians 6:1
Home
Bible
Plans
Videos