So Ananias go di house and wen e enter, e put en hand for Saul head kon sey, “Broda Saul, di Oga God wey show ensef to yu for road wen yu dey kom here, na en send mi kom meet yu, so dat yu go fit si again kon receive di Holy Spirit.” At wons, sometin wey bi like fish skale fall komot from Saul eye and e kon dey si. E get up and dem baptize am.