Naim di Holy Spirit tell Filip, “Make yu waka go meet di man.” So Filip run go meet am kon hear am dey read wetin Profet Isaya rite. So e ask di man, “Yu undastand wetin yu dey read so.” Di man ansa, “How I won take undastand, unless pesin tish mi!” E kon tell Filip sey make e kom sidan with am.