YouVersion Logo
Search Icon

Acts 8

8
Saul Ponish Di Church
1Saul happy wen dem dey kill Stefen.
Na from dat day trobol start for di church wey dey Jerusalem and all di bilivers kon skata go Judea and Samaria, but na only di apostles nor run. 2Some men wey dey holy, karry Stefen go beri afta dem don mourn for am. 3But Saul try to distroy di church; e dey go from house to house dey arrest men and wimen put for prison.
Filip Prish For Samaria
4So di pipol wey skata kon dey go from place to place dey prish di gospel. 5Filip travel go Samaria main town kon dey prish about di Mezaya give dem. 6Di pipol wey gada, put dia mind for wetin Filip dey tok, bikos dem don hear and si all di mirakles wey e do. 7Wiked spirit dey shaut and dey komot from pipol body as dem hear God word and God heal many pipol wey nor fit waka. 8So all di pipol wey dey di town kon dey happy well-well, bikos of wetin dey happen.
9E get one strong man for di town wey dem dey koll Simon and e dey do majik wey dey make Samaria pipol sopraiz. 10Evribody, both small pikin and big pipol, dey bilive wetin e dey do and dem bilive sey, “Na God gi-am pawa!” 11Dem dey listin to am bikos, e don tey wen e dey use majik take dey do wonders. 12But wen dem bilive di Good News wey Filip prish about God Kingdom and about Jesus Christ, dem kon baptize di pipol wey bilive. 13Even Simon sef bilive and afta dem don baptize am, e kon dey waka with Filip, bikos all di mirakles wey God dey do thru Filip, dey sopraiz am.
14Wen di apostles wey dey Jerusalem hear sey Samaria pipol don receive God word, dem kon send Pita and John go meet dem, 15so dat dem go pray for di pipol, make dem for receive di Holy Spirit. 16Bikos for dat time, dem neva receive di Holy Spirit. Na only Jesus name dem take baptize dem. 17Pita and John put hand for di pipol head and dem kon receive di Holy Spirit.
18Wen Simon si sey pipol dey receive di Holy Spirit as di apostles put hand for dia head, e give di apostles money 19kon sey, “Abeg, make una give mi dis pawa, so dat I go fit put my hand for pipol head and dem go receive di Holy Spirit too.” 20But Pita ansa am, “Make yu and yor money go die! Yu tink sey yu fit buy God gift with money? 21Yu nor get share for inside dis tin wey God dey give, bikos God don si sey na bad tin yu won take am do. 22So make yu turn from sin kom meet God and from di bad tins wey dey yor mind and pray make God forgive yu. 23Bikos I si sey na long-trot and bad belle dey worry yu and sin still full yor mind.” 24Simon tell Pita, “Make yu pray to God for mi, so dat di tin wey yu tok so, nor go happen to mi.”
25Afta Pita and John don tell dia story and prish God word finish, dem kon go back to Jerusalem, dey prish God word for inside Samaria, as dem dey go.
Filip With Ethiopia Man
26God angel kon tell Filip, “Get up make yu waka for di wildaness road wey dem dey pass from Jerusalem go Gaza.” 27So Filip kon dey waka dey go where di angel tell am. As e dey go, e meet one uncle wey kom from Ethiopia, e bi offisa for Kandace wey bi Ethiopia kween and na-im dey keep dia money. E kon woship God for Jerusalem 28and e dey go house back. E sidan for en horse dey read di book wey Profet Isaya rite. 29Naim di Holy Spirit tell Filip, “Make yu waka go meet di man.” 30So Filip run go meet am kon hear am dey read wetin Profet Isaya rite. So e ask di man, “Yu undastand wetin yu dey read so.” 31Di man ansa, “How I won take undastand, unless pesin tish mi!” E kon tell Filip sey make e kom sidan with am. 32Na di place wey e dey read for God word bi dis,
“Dem lead am like sheep go kill
and as sheep pikin dey kwayet wen dem dey shave am,
na so too e nor open en mout.
33Dem disgrace am kon take pawa from en hand.
Nobody go fit tok about en shidren or en grand-shidren,
bikos dem kill-am wen e still dey yong.”
34So di man ask Filip, “Abeg tell mi, na who dis profet dey tok about? Na ensef, abi na anoda pesin?” 35Filip kon start to prish di Good News about Jesus Christ give di man from di place wey e dey read. 36As dem dey go, dem kon rish where wota dey, naim di man sey, “Si, wota dey here! Wetin go make mi nor baptize naw?” 37Filip ansa, “If yu bilive, I go baptize yu.” Di man kon sey, “I bilive sey Jesus Christ na God Pikin.” 38So e tell di driver make e stop, Filip with am waka go where di wota dey and e kon baptize am. 39Wen dem kom out from di wota, God Spirit karry Filip komot from der and di man nor si am again, but e kon dey happy as e dey go. 40Filip si ensef for Azotus and as e dey waka pass for di aria, e kon dey prish di Good News for all di towns till e rish Caesaria.

Currently Selected:

Acts 8: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in