1
1 Tesalonians 4:17
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
God go karry wi wey remain for dis world go meet dem for sky, den all of us go-go meet Christ for heaven.
Compare
Explore 1 Tesalonians 4:17
2
1 Tesalonians 4:16
God big angel go shaut dey kommand as Christ dey kom down from heaven; di angel vois go dey loud with God trumpet and doz wey bi Christian before dem die, go first go up.
Explore 1 Tesalonians 4:16
3
1 Tesalonians 4:3-4
Na wetin God wont bi dis: Make una dey holy; komot hand for bad tins; nor sleep with who nor bi yor wife or husband. Una wey bi man, make una dey live with una wife for holiness and with respet
Explore 1 Tesalonians 4:3-4
4
1 Tesalonians 4:14
Since wi bilive sey Jesus die and e wake-up; na so too wi bilive sey, doz wey bi Christian before dem die, God go raiz dem up.
Explore 1 Tesalonians 4:14
5
1 Tesalonians 4:11
Make una dey do well, so dat una go live kwayet life; dey mind una own business and dey work with una hand as wi kommand una before.
Explore 1 Tesalonians 4:11
6
1 Tesalonians 4:7
Bikos God nor koll us to live yeye life, but na to live holy life.
Explore 1 Tesalonians 4:7
Home
Bible
Plans
Videos