1
1 Tesalonians 5:16-18
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Make una dey happy evritime. Make una dey pray evritime. Make una dey tank God for evritin, bikos na so God wont sey make una wey dey inside Christ dey do.
Compare
Explore 1 Tesalonians 5:16-18
2
1 Tesalonians 5:23-24
Make God wey dey give peace, help una to dey holy go rish di end, so dat for di day wen Christ go kom, una spirit, soul and mind go dey without fault. Di Pesin wey koll una to do en work dey faithful.
Explore 1 Tesalonians 5:23-24
3
1 Tesalonians 5:15
Make una dey sure sey nobody pay bad for bad, but for evritime, make una always dey do good for each oda and for evribody.
Explore 1 Tesalonians 5:15
4
1 Tesalonians 5:11
So make una dey enkourage and help each oda, just as una dey do naw.
Explore 1 Tesalonians 5:11
5
1 Tesalonians 5:14
Wi dey beg una, awa brodas and sistas, make una tell pipol wey dey bihave anyhow sey, wetin dem dey do nor good, den make una help doz wey dey weak, but make una dey patient with evribody.
Explore 1 Tesalonians 5:14
6
1 Tesalonians 5:9
Bikos God nor choose us to sofa en vexnashon, but to get salvashon thru awa Oga God Jesus Christ
Explore 1 Tesalonians 5:9
7
1 Tesalonians 5:5
bikos all of una na lite shidren. Wi nor bi nite or darkness shidren
Explore 1 Tesalonians 5:5
Home
Bible
Plans
Videos