1
Jenesis 50:20
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Even doh una mind na to kill mi, but God let am bi like dat, make betta tins for happen, so dat many pipol go dey save as una dey si today so.
Linganisha
Chunguza Jenesis 50:20
2
Jenesis 50:19
But Josef ansa dem, “Make una nor fear. Na God know wetin E won do.
Chunguza Jenesis 50:19
3
Jenesis 50:21
So, make una nor fear. Evritin wey una wont, I go give una and una shidren and family.” Den e follow dem tok well.
Chunguza Jenesis 50:21
4
Jenesis 50:17
‘Make una tell Josef: “Make yu forgive yor brodas dia sins and di bad tins wey dem do yu.” ’ Naw make yu forgive di sins wey yor broda God savant, kommit.” Wen dem tell Josef di message, Josef kry well-well.
Chunguza Jenesis 50:17
5
Jenesis 50:24
Den Josef tell en brodas, “Na die I dey so. But God go true-true kom meet and take una go di land wey E promise sey E go give Abraham, Isaak and Jakob.”
Chunguza Jenesis 50:24
6
Jenesis 50:25
Josef kon make Israel pipol swear. E tell dem, “God go really kom meet una. Den una must karry my bones follow body komot from dis place.”
Chunguza Jenesis 50:25
7
Jenesis 50:26
So Josef die wen e bi one hundred and ten years. Afta dem don dress en body dem kon put am for one koffin for Egypt.
Chunguza Jenesis 50:26
Nyumbani
Biblia
Mipango
Video