1
Jenesis 49:10
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Di pawa rod nor go komot from Judah and di pawa to take rule, go always dey en leg, until e go rish di pesin wey really get am and evribody go obey yu.
Linganisha
Chunguza Jenesis 49:10
2
Jenesis 49:22-23
Josef na betta vine wey dey produce good food; betta vine wey dem plant near wota and en branches dem dey klimb di wall. Hunta go attack am, dem go shot and oppoz am.
Chunguza Jenesis 49:22-23
3
Jenesis 49:24-25
But en bow go dey strong and e nor go move and e hand go sabi work bikos of Jakob God, di Shepad, wey bi di Rock for Israel, una papa God wey go help una, di God wey get pawa wey go bless una with di blessing wey dey di sky for up; di Pesin wey get blessings wey dey wota and under di eart and even di ones from animals.
Chunguza Jenesis 49:24-25
4
Jenesis 49:8-9
Yu Judah, yor brodas go praiz yu. Yor hand go strong pass yor enemy own. Yor papa sons go bow down for yu. Judah my pikin, yu bi yong lion wey just chop wetin e kill finish. Yu dey kill like lion kon kwayet dey look; yu bi like woman lion, na who go fit fight am?
Chunguza Jenesis 49:8-9
5
Jenesis 49:3-4
Reuben, na yu I first-born, my strent and di first fruit wey I plok. Na yu bi di nomba one, both for rank and pawa. But yu dey skata tins like wota, so yu nor go prosper, bikos yu sleep with yor papa wife for my bed!
Chunguza Jenesis 49:3-4
Nyumbani
Biblia
Mipango
Video