YouVersion Logo
Search Icon

Song of Songs 2

2
Di Woman
1Na mi bi di Rose flower from Sharon,
di lily flower for di valley.
Di Man
2Just as lily flower dey among shuku-shuku,
na so my darlin bi among oda yong wimen.
Di Woman
3Just as apple tree dey among oda trees for forest,
na so my love bi among di yong men.
I dey like sidan for where e dey
and en fruit dey sweet mi to chop.
4E take mi go di party
kon show mi as e love mi rish.
5E give mi kake, so dat I go get pawa
kon add apples join am,
bikos en love won make mi faint.
6E dey rub my head with en left hand
kon dey massage mi with en rite hand.
7Jerusalem wimen! Make una promise mi with animals,
like deer and gazelle sey,
una nor go disturb awa love.
8Make una listin! My love dey kom.
Si! E dey pass di mountins
and di hills dey kom meet mi.
9My love bi like gazelle or yong deer.
Look! E stand for back of awa wall,
where e for dey look di room thru di window.
10My love tell mi sey, “Get up, my darlin!
My fine wife,
make yu kom follow mi go!
11Si! Kold sizin don pass
and rain nor dey fall again.
12Di flowers don dey grow
and di time wen birds dey sing,
don kom and naw,
wi dey hear dove dey sing for awa land.
13Fig tree don dey bring fig fruit kom out
and di breeze dey scent with fresh vines.
So get up, make yu follow mi, my darlin and sweet wife;
kom follow mi make wi dey go!”
Di Man
14Yu bi like dove wey hide inside rock,
so make yu allow mi si yor fine face
kon hear yor sweet vois.
15Make una katch all di fox for us;
especially di small-small ones,
before dem go distroy awa vineyard.
Di Woman
16My love na my own and I bi en own too;
e dey feed en animals for where lilys dey.
17My love, before di morning breeze go blow and darkness go disappear,
make yu kom back kom meet mi like gazelle or yong deer
wey dey on-top mountin.

Currently Selected:

Song of Songs 2: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in