Song of Songs 1
1
Introdushon
1Dis na Solomon love song.
Di Woman
2Yes! Make yu kiss mi well-well,
bikos to sleep with yu sweet pass wine.
3Si as yor perfume dey scent well-well
and yor name bi like di perfume wey fine pass.
No wonder wimen love yu well-well!
4Draw mi follow yu! Make wi kwik komot here!
Make di king take mi go en room.
Awa king, wi dey happy well-well,
bikos of yu and wi like yor love pass wine.
Yes, di yong wimen dey honor yu
and dat na di rite tin to do.
5Jerusalem wimen,
I bi black and fine woman;
I black like Kedar and Solomon tents.
6So make una nor dey look mi anyhow
bikos sun don make my skin black.
My brodas dey vex for mi, so dem kon force mi dey work for farm
and bikos of dat, I nor fit kare for my body.
7My love, make yu tell mi!
Na where yu won go feed yor animals today?
Where yor sheep dem go for rest dis aftanoon?
Make yu tell mi, if not I go dey waka up-and-down
like ashawo for where yor friends and dia animals dey!
Di Man
8My woman!
Di one wey fine pass among wimen!
If yu dey find mi, make yu follow my animals
footstep rish where I dey
kon kare for yor small goats near di shepad tent.
9My love, yu bi like woman horse for where Fero man horse dem dey.
10Yor face dey shine well-well, bikos of di oil wey dem take rub am
and di difren shains wey yu wear, don make yor neck fine too.
11So, wi go make gold ear-ring
and silva beads for yu.
Di Woman
12As di king sidan for en tabol where e for dey do party,
my perfume smell kon make am dey happy.
13As my love put en head on-top my breast thru-out di nite,
en whole body kon dey smell like myrrh.
14My love bi like Henna flower
wey dey shine well-well for En-Gedi Field.
Di man
15Si as my darlin fine well-well,
make yu si as yu fine rish!
Yor eyes bi like dove own!
Di Woman
16Yes! Yu too fine my love and I dey happy to always dey with yu.
Na di grass go bi awa bed
17and na cedar wi go take design awa house
kon build di roof with Cypress tree.
Currently Selected:
Song of Songs 1: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee