Romans 9
9
God Pipol
1Na di trut I dey tok, na Jesus get mi and di Holy Spirit dey bear witness for my mind sey, I nor dey lie wen I sey, 2e dey pain mi for mind and sorrow full my heart, 3bikos I for like sey God go curse and separate mi from Christ, so dat my own flesh and blood, 4wey bi Israel pipol, go fit asept Christ. Na dem God choose as en own shidren, E make agriment with dem kon give dem en law. Na dem get di temple and wetin God promise. 5Awa grand-grand papa dem wey follow God waka before, na from dem dis pipol from kom. So I dey pray make dem praiz God wey dey rule evritin forever and ever! Amen.
6Nor bi sey God promise don fail; bikos nor bi evribody wey dey Israel really bi God pipol. 7And nor bi all Abraham pikin bi God shidren. Instead, God tell Abraham, “Na thru Isaak yu go get di shidren wey I promise yu.” 8Dis mean sey di pikin wey Abraham born (Hagar pikin, Ishmael) before God promise am, nor bi di one wey God choose. Instead, di pikin wey e born thru God promise, na dat one bi Abraham true pikin. 9Bikos na so God tok for en promise, “Wen di time don rish, I go kom back and Sarah go born boy.” 10Nor bi only dat, bikos Rebekah shidren na one papa dem get and naim bi awa grand-grand papa, Isaak. 11Even before dem born di shidren or sey dem do any bad or good tin, God tell Rebekah, “Di senior pikin go serve en junior broda, so dat my promise go stand: 12nor bi bikos of wetin dem do, but na as I wont make e bi.” 13Just as God word sey, “I love Jakob, but I hate Esau.” 14Wetin wi go tok? Wi go sey God dey show parsha? No! 15Bikos E tell Moses sey, “I go sorry for who I won sorry for and I go show mesi to who I like show mesi to.” 16Derfor, evritin dey for God hand, nor bi by wetin pipol won do. 17God tell Fero for en word sey, “I make yu king, so dat I go use yu show my pawa and pipol go fear my name for di whole world.” 18So, God dey sorry for who E won sorry for and dey ponish who E won ponish.
19I know sey yu go ask sey, “Wetin make God dey find fault for pipol body, since na-im make us dey do as wi dey do?” 20But, my friend, I dey ask, “Who yu tink sey yu bi, wey make yu dey ask God kweshon? Pot wey dem mold fit ask di pesin wey dey mold am sey, ‘Why yu dey mold mi like dis?’ ” 21Di man wey mold di pot fit use di klay as e like. E fit use di klay make two pot, one for big party and di oda one for house. 22But God won show sey E dey vex, so E kon use en pawa against doz wey E won ponish. 23E dey do like dis to show en glory wen E pity for pipol wey E choose to show en glory. 24Weda wi bi Jew or Gentile pipol, E don choose us. 25As E tok for Hosea book sey,
“Doz wey nor bi my pipol before
and di pipol wey nobody love before,
I go koll dem, ‘Di pipol wey I love.’
26For where God for tell dem sey,
‘Una nor bi my pipol,
na der dem go for still koll dem “God shidren.” ’ ”
27And dis na wetin Profet Isaya tok about Israel pipol, “Israel shidren many like san-san wey dey wotaside. But na few of dem, God go save. 28Bikos God go kwik do wetin E sey E wont do for dis world, E go kom judge di world.” 29Just as Profet Isaya tok before sey:
“If to sey God Almighty nor save some among awa shidren,
wi for don die finish like Sodom and Gomorrah.”
Israel Pipol Nor Bilive
30Wetin wi go tok? Even doh Gentile pipol nor dey raitious before, dem don dey raitious naw, bikos of faith. 31And Israel pipol wey dey try to do wetin God wont, nor fit do am. 32Why dem nor fit do am? Na bikos dem dey try to do good like sey na by work, nor bi with faith. Na dis make dem dey struggol kon dey fall on-top stone. 33God word sey:
“Si, for Zion, I dey arrange stones
wey go make pipol fall,
yet doz wey bilive am,
E nor go disappoint dem.”
Currently Selected:
Romans 9: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee