Romans 10
10
1My brodas and sistas, I dey wish and pray to God from my heart evriday sey, make God save dem wey kom from Israel. 2I know sey dem love God, but dem nor undastand am, 3as e bi sey dem nor know how God dey take make pipol good, instead, dem dey try to make demsef good by dia own pawa, since dem nor gri do wetin God wont. 4Since Jesus Christ kom, di law nor get pawa again and anybody wey bilive God, go dey raitious.
5Na dis raitiousness wey di law tok, naim Moses rite about sey: “Di pesin wey follow di law must do evritin wey di law tok.” 6But di raitiousness wey faith dey give pesin na sey: “Nor tok for yor mind sey, ‘Who go-go heaven go bring Jesus Christ kom down? 7Or Who go-go bring Christ kom out from hell where dead body dey?’ ” 8But wetin e tok? “God word dey near yu. Di word wey wi dey prish near yu, e get faith and e dey yor mout and heart.” 9But if yu konfess with yor mout sey, “Jesus Christ na Oga God and yu bilive for yor heart sey, God raiz am from grave, yu go dey save.” 10If yu bilive and prish with yor heart give pipol sey Jesus Christ na Oga God, God go save yu. 11Bikos God word sey, “Anybody wey bilive am, nor go shame.” 12Jew and Gentile pipol nor dey difren for God eye and E dey bless evribody wey dey pray to am, 13bikos E go save doz wey dey koll en name.
14How dem won take koll God make E help dem, wen dem nor bilive am? And how dem go fit bilive, wen dem neva hear about am? How dem go take hear about am, if nobody prish to dem? 15How pesin go prish God word wen God nor send am? As God word sey, “Pipol wey dey prish di Good News dey waka well, bikos na good tins dem dey bring!” 16But nor bi evribody gri asept di Good News, even Profet Isaya sey, “My God, anybody don bilive awa message?” 17So, nobody go fit get faith wen e neva hear di message and na thru Christ word, wi go fit hear am.
18But make I ask, dem neva hear di message before? Yes! Dem don hear am, bikos God word sey, “Dem prish di message and dia vois rish evriwhere for di world.” 19I dey ask una again, “Israel pipol nor undastand?” Moses first tok sey, “I go use pipol wey nor bi anytin, so dat una go dey jealous dem. Na pipol wey nor get sense, na dem I go use take make una vex.” 20And Profet Isaya even get strong heart to tell di pipol sey, “Pipol wey nor look for mi, na dem si mi. Doz wey nor ask for mi, na dem kon know mi well-well.” 21But Profet Isaya still tok about Israel pipol sey, “I don dey koll dis my sturbon pipol, but dem nor dey hear word.”
Currently Selected:
Romans 10: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee