Romans 2
2
God Judgement
1Pesin wey dey judge odas nor get eskuse for wetin e dey do and e nor matter who en bi. Bikos wen yu judge odas and yu dey do di same tin wey dem dey do, yu dey kondemn yorsef. 2Wi know sey God nor dey lie wen E dey judge pipol wey dey do bad tins. 3Yu wey dey do tins wey yu sey make odas nor do! Yu tink sey yu go eskape God judgement? 4May bi una dey take God kindness, patient and endurance as yeye tins. Una nor know sey God dey kind, bikos E wont make una turn from sin kom meet am? 5But una sturbones and strong heart nor let una turn from sin kom meet God, so una dey make una ponishment many more-more, for di Day wen God go judge di world, bikos en na judge wey nor dey support bad tins. 6God go pay evry man akordin to wetin e do. 7God go give life wey nor dey end to di pipol wey dey do good, wey wont glory, honor and long life. 8But E go show en vexnashon and ponish doz wey bikos of long-trot rijet di trut kon dey do bad tins. 9Anybody wey dey do bad tin, weda e bi Jew or Gentile, must sofa and receive ponishment. 10But God go give glory, honor and peace to anybody wey dey do good, weda e bi Jew or Gentile, 11bikos God go judge evribody di same way. 12Even doh Gentile pipol nor get Moses Law, God still dey ponish dem wen dem sin, so Jew pipol wey get di law, wen dem sin, na di law go judge dem. 13Bikos yu dey hear di law nor mean sey yu good for God eye, but na wen yu do wetin di law tok. 14Gentile pipol nor get di law, but dem dey use dia sense do wetin di law tok and dat one don turn law for dem, even doh dem nor know Moses Law. 15Di way dem dey bihave show sey wetin Moses rite for di law, dey dia heart and dia mind dey tell dem sey, “Dis tins dey rite and e go kondemn or free us from wetin wi do.” 16So just as I prish give una, na so e go bi for dat day, wen God go judge all di sekret tins wey dey pipol heart thru Jesus Christ wey bi en pikin.
Jew Pipol And Di Law
17Wot of yu wey sey yu bi Jew? Yu wey put yor hope for di law kon dey use God dey boast; 18yu know wetin God wont make yu do and yu don learn how to do good tins, bikos yu know di law. 19Yu dey show blind pipol road and dey help doz wey dey for darkness si lite, 20and yu dey tish foolish pipol and small shidren wey nor know anytin, bikos yu know sey, di trut and evritin wey man nid to know, dey for di law. 21Yu wey dey tish odas, why yu nor fit tish yorsef? Yu wey dey prish sey make pipol nor tif, yu sure sey yu nor dey tif? 22Yu wey sey make pipol nor kommit adultery, yu nor dey kommit adultery? Yu wey sey yu hate juju, yu nor dey take tins wey dem keep for juju house? 23Yu wey dey take di law boast, yu dey bring shame to God name, bikos yu dey disobey di law! 24Just as God word sey, “Bikos of una wey bi Jew pipol, Gentile pipol dey take God name make yeye.”
25Sekonsishon get value only if yu dey do wetin di law tok, but if yu nor dey obey di law, yu and di pesin wey dem neva sekonsaiz na di same. 26So if Gentile pipol wey dem nor sekonsaiz dey obey evritin for di law, yu nor tink sey God go take dem as pipol wey dem sekonsaiz? 27Yu nor know sey di pesin wey dem nor sekonsaiz go judge yu wey bi Jew, since yu dey break di law? 28Pesin nor bi Jew bikos of wetin pipol si from outside. Di really sekonsishon nor bi wetin pipol dey si, 29but di really Jew na pesin wey bi Jew for inside en heart, bikos sekonsishon nor dey tosh pesin heart. Na di Holy Spirit dey do dis kind work, nor bi di law wey dem rite down and dat pesin go dey receive praiz from God, even doh human being nor praiz am.
Currently Selected:
Romans 2: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee