1
Romans 2:3-4
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Yu wey dey do tins wey yu sey make odas nor do! Yu tink sey yu go eskape God judgement? May bi una dey take God kindness, patient and endurance as yeye tins. Una nor know sey God dey kind, bikos E wont make una turn from sin kom meet am?
Compare
Explore Romans 2:3-4
2
Romans 2:1
Pesin wey dey judge odas nor get eskuse for wetin e dey do and e nor matter who en bi. Bikos wen yu judge odas and yu dey do di same tin wey dem dey do, yu dey kondemn yorsef.
Explore Romans 2:1
3
Romans 2:11
bikos God go judge evribody di same way.
Explore Romans 2:11
4
Romans 2:13
Bikos yu dey hear di law nor mean sey yu good for God eye, but na wen yu do wetin di law tok.
Explore Romans 2:13
5
Romans 2:6
God go pay evry man akordin to wetin e do.
Explore Romans 2:6
6
Romans 2:8
But E go show en vexnashon and ponish doz wey bikos of long-trot rijet di trut kon dey do bad tins.
Explore Romans 2:8
7
Romans 2:5
But una sturbones and strong heart nor let una turn from sin kom meet God, so una dey make una ponishment many more-more, for di Day wen God go judge di world, bikos en na judge wey nor dey support bad tins.
Explore Romans 2:5
Home
Bible
Plans
Videos