Romans 14
14
Nor Judge Odas
1Make una dey welkom God pipol. Even doh dia faith nor too strong, make una nor curse dem, bikos of wetin dem dey tink sey dey good or bad. 2Some pipol tink sey e dey rite to chop any food and odas wey dia faith dey weak, dey chop only vegitabol. 3Since God dey welkom evribody, make una nor kondemn odas bikos dem chop or dem nor chop wetin una like. 4Wish rite yu get to kondemn anoda pesin savant? Na only dia oga fit tok weda dem dey do well and e must make sure sey, dem do di rite tin.
5Some pipol tink sey one day betta pass anoda and some tink sey, evriday na di same. But make evribody bilive wetin dem won bilive. 6Anybody wey tink sey one day betta pass anoda, dey do so to honor God. And anybody wey chop meat, dey tank God just like di pesin wey nor won chop. 7Nobody dey live or die for ensef. Weda wi die or wi live, na God still get us. 8If wi live, na God wi dey live for; if wi die, na God wi still die for. So, weda wi die or wi live, na God still get us. 9Dis na bikos Christ die and e kom back to life, so dat e go bi Oga God to pipol wey don die and doz wey dey alive.
10But why yu dey kondemn oda Christians? Why yu dey si dem as small shidren? Di day dey kom wen God go judge all of us. 11God word sey, “Weda dem like am or not, evribody go knee down for my front kon sey na mi bi God.” 12So, all of us go tell God wetin wi do with awa life.
Strong And Week Pipol
13So, make wi nor dey judge one anoda and make wi nor spoil anoda pesin faith. 14As I don know Christ, e don make mi know sey all food dey klean. But if yu tink sey e nor good make yu chop some food, dat nor mean sey, e nor good for anoda pesin. 15Bikos if di food wey yu chop make yor broda or sista vex for yu, den yu nor dey show love again. So make yu nor let di kind food wey yu dey chop, offend di pesin wey Jesus Christ die for. 16Nor let pipol curse Jesus Christ, bikos of di food wey yu dey chop. 17Bikos God kingdom nor bi food and drink matter, but na about raitiousness, peace and joy wey di Holy Spirit dey give pipol. 18If yu serve Christ like dis, God go dey happy with yu and pipol go respet yu.
19So, make wi live for peace, den wi go help each oda grow as dem dey serve God. 20Nor skata God work bikos of food. Evry food dey okay, but e nor good make yu chop wetin go spoil anoda pesin faith. 21E betta make yu nor chop meat, drink wine or do anytin wey fit spoil yor brodas faith. 22Anytin wey yu bilive about dis matter, make yu keep am to yorsef and God wey dey heaven, dey si am. God don bless di pesin wey nor kondemn ensef, bikos of wetin e do. 23But if yu dey doubt wetin yu chop, den yu dey kondemn yorsef and yu know sey dat nor good, bikos anytin wey yu do against wetin yu bilive, na sin.
Currently Selected:
Romans 14: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee