1
Romans 14:17-18
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Bikos God kingdom nor bi food and drink matter, but na about raitiousness, peace and joy wey di Holy Spirit dey give pipol. If yu serve Christ like dis, God go dey happy with yu and pipol go respet yu.
Compare
Explore Romans 14:17-18
2
Romans 14:8
If wi live, na God wi dey live for; if wi die, na God wi still die for. So, weda wi die or wi live, na God still get us.
Explore Romans 14:8
3
Romans 14:19
So, make wi live for peace, den wi go help each oda grow as dem dey serve God.
Explore Romans 14:19
4
Romans 14:13
So, make wi nor dey judge one anoda and make wi nor spoil anoda pesin faith.
Explore Romans 14:13
5
Romans 14:11-12
God word sey, “Weda dem like am or not, evribody go knee down for my front kon sey na mi bi God.” So, all of us go tell God wetin wi do with awa life.
Explore Romans 14:11-12
6
Romans 14:1
Make una dey welkom God pipol. Even doh dia faith nor too strong, make una nor curse dem, bikos of wetin dem dey tink sey dey good or bad.
Explore Romans 14:1
7
Romans 14:4
Wish rite yu get to kondemn anoda pesin savant? Na only dia oga fit tok weda dem dey do well and e must make sure sey, dem do di rite tin.
Explore Romans 14:4
Home
Bible
Plans
Videos