Psalms 8
8
God Glory And Man Honor
David Song
1Oga awa God, yor greatness full di whole world!
Yor glory high pass di heavens.
2Yu don tish shidren and small pikin,
so dat dem go fit tok about yor pawa
and how Yu take silent yor enemies and doz wey dey oppoz Yu.
3Wen I look di sky for nite kon si di work wey Yu do;
di moon and di stars wey Yu keep for dia place,
4I dey ask mysef,
“Wetin pipol bi wey Yu dey tink about dem?
Na ordinary human being Yu dey kare about?”
5Yu make dem bi like Yu
kon give dem glory and honor.
6Yu sey make dem kare for evritin wey Yu kreate,
bikos Yu put evritin under dia kontrol;
7all di animals,
both wiked and di ones wey nor wiked,
8di birds for di sky, di fish for sea
and evritin wey dey swim for wota.
9Oga awa God,
yor greatness full di whole world.
Currently Selected:
Psalms 8: pcm
Highlight
Share
Compare
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee