Psalms 28
28
Prayer For Help
David Song
1I dey pray to Yu, my God wey bi my rock.
Make Yu ansa mi.
Bikos if Yu kwayet, life go taya mi and I go kwik die.
2Make Yu listin to my prayer for mesi as I dey kry to Yu for help
and as I lift up my hand for yor holy temple.
3Make Yu nor drag mi follow pipol wey dey do wiked;
doz wey dey tok like sey dem bi friend to dia neighbour,
but dem dey plan bad tins for dem for dia mind.
4Make Yu ponish dem for dia wikedness!
Ponish dem akordin to di bad tins wey dem do,
den reward dem for all dia wiked plans!
5Dem nor kare about di tins wey God do or wetin God make with en own hand.
So, God go skata dem finish and dem go disappear forever!
6I go praiz God,
bikos E don hear my kry for help!
7Na God bi my strent, my guide and I trust am with all my heart.
My heart dey happy well-well, bikos God help mi.
So, I go always dey sing dey tank am.
8God dey give en pipol strent and en king dey save,
bikos E dey protet am.
9So God, make Yu save yor pipol!
Make Yu bless Israel pipol wey bi yor special propaty.
Make Yu guide dem like shepad kon karry dem for yor hand forever.
Currently Selected:
Psalms 28: pcm
Highlight
Share
Compare
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee