YouVersion Logo
Search Icon

Psalms 150

150
Praiz God
1Make wi Praiz God!
Make wi praiz am for en temple;
make wi praiz am for di sky wey dey tok about en great pawa!
2Make wi praiz am for di big-big tins wey E dey do;
make wi praiz am, bikos en greatness good pass evritin!
3Make wi praiz am with trumpet sound;
make wi praiz am with jita and harp!
4Make wi dance praiz am with sheke-sheke;
make wi praiz am with jita and flute!
5Make wi dey nak cymbals togeda as wi dey praiz am.
Yes! Make wi praiz am with loud cymbals.
6Make evritin wey dey alive, sing praiz God.
Make evribody praiz God!

Currently Selected:

Psalms 150: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in