YouVersion Logo
Search Icon

Psalms 149

149
Praiz Song
1Make wi praiz di Oga wey bi awa God
kon sing new song to am.
Make wi sing praiz am
for where en pipol gada put.
2Israel pipol, make una happy bikos of di Pesin wey kreate una.
Jerusalem pipol, make una praiz God well-well.
3Make una dance praiz en name with sheke-sheke and jita,
4bikos God like en pipol and doz wey honbol demsef,
E dey make dem win.
5Make doz wey dey fear am, happy, bikos E go fight for dem!
Make dem shaut for joy as dem dey sleep for dia bed!
6As dem hold swod wey get two mout for dia hand,
make dem praiz God,
7so dat dem go fit revensh dia enemies
kon ponish di strenjas.
8Dem tie dia enemies kings with shains
and dia priests with iron
9and dem dey judge dem just as dem rite am.
God go fight for evribody wey dey serve am!
So make wi praiz di Oga wey bi awa God!

Currently Selected:

Psalms 149: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in

Video for Psalms 149