Proverbs 3
3
Advise For Yong Men
1My pikin, make yu nor forget wetin I tish yu
and always remember wetin I sey make yu dey do.
2Wetin I tish yu
go make yu prosper and get long life.
3So make yu always get faith and dey honbol;
tie trut and mesi round yor neck kon rite dem for yor heart.
4If yu do like dat,
both God and human being go dey happy and favor yu.
5Make yu always dey trust God with all yor heart,
but nor trust wetin yu tink sey yu know.
6Always dey remember God kommand for anytin wey yu dey do,
den E go show yu di korrect way.
7Nor tink sey yu wise pass di way yu bi,
but just obey God and nor do bad tins.
8If yu do like dis,
yor body go dey okay and yor bones go strong well-well.
9Honor God with yor money
kon offa di first fruit wey yu harvest from yor farm gi-am.
10If yu do so, korn go full yor store
and yu go get plenty wine to keep.
11My pikin, if God korrect yu,
listin well and take am as warnin.
12Bikos God dey korrect only di pipol wey E love,
just as papa dey korrect di pikin wey e dey proud of.
13Pesin wey wise and get undastandin,
na happiness go bi en own.
14Undastandin get gain pass silva
and e betta pass gold.
15Wisdom get value pass gold
and e nor get anytin wey yu fit use take kompare am.
16E go give yu long life,
plenty propaty and honor.
17E go still make yor life sweet
and yu go dey save.
18Wisdom na tree wey dey give life
and e dey make pipol wey kom meet am, happy.
19God kreate di eart with en wisdom
and na en undastandin E take make di heavens.
20Na en wisdom make river dey flow
and na-im dey make kloud bring rain kom di eart.
21So my pikin, whole di wisdom and undastandin wey yu get well
and yu nor ever let dem live yu.
22Dem go make yu live sweet and happy life.
Dem go bi like betta shain for yor neck.
23Dem go make yu dey save for anytin wey yu dey do
and yu nor go ever fall.
24Fear nor go katch yu wen yu dey sleep
and yu go sleep well still day break.
25Yu nor nid to worry about wahala wey go just happen,
just as e dey go meet wiked pipol.
26God go save yu
and E nor go let trap katch yu.
27Anytime wey yu fit,
make yu do good to pipol wey nid am.
28Nor ever tell yor neighbour make e wait till tumoro,
if yu know sey yu fit help am naw.
29Nor ever plan bad against yor neighbour,
bikos doz wey dey stay near yu, trust yu.
30Nor argue with pesin just bikos yu won argue,
wen yu know sey e nor do yu bad.
31Nor jealous or bigin bihave like pipol
wey like wahala well-well,
32bikos God hate pipol wey dey do evil,
but E dey draw raitious pipol near body.
33God don curse wiked pipol house,
while blessings full raitious pipol own.
34God nor get wetin E won do with proud pipol,
but E dey favor pipol wey dey honbol.
35Pipol wey wise go get good name,
but fools go only add trobol join dia disgrace.
Currently Selected:
Proverbs 3: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

:
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee