Proverbs 2
2
Reward Wey Wisdom Dey Give
1My pikin, make yu listin to wetin I dey tish yu
and nor ever forget wetin I sey make yu do.
2Listin to wetin dey wise
and try make yu undastand am.
3Yes, make yu beg for wisdom
and yu go get undastandin.
4Find am well-well,
just as yu go take look for silva or oda good tins.
5If yu do like dat, yu go know wetin e mean to fear God
and yu go susid as yu dey learn about God.
6Na God dey give wisdom!
Na from en mout knowledge and undastandin dey from kom.
7E dey help and protet
raitious and honest pipol.
8E dey protet pipol wey dey trit odas well
kon guide doz wey dey respet am.
9So, if yu listin to wetin I dey tok;
yu go know wetin dey rite, true and korrect,
den kon know wetin yu suppose do.
10Yu go dey wise and di sense wey yu get
go give yu happiness.
11Di sense and undastandin wey yu go get,
go protet yu.
12Wisdom go save yu from wiked pipol;
from doz wey dey lie well-well.
13From pipol wey live good life before
dem bigin do bad-bad tins;
14and dem dey happy to do
yeye and wiked tins.
15E go still save yu from pipol
wey dem nor fit trust;
16from ashawo wimen wey get sweet mout
and doz wey won sleep with yu.
17Dis kind woman nor dey faithful to en husband
and e don forget di holy promise wey e make.
18If yu go en house,
yu just won kill yorsef bi dat.
19Nobody wey go visit am, dey kom back alive.
True-true, e nor go ever kom back to life again.
20So, make yu follow wetin good pipol dey do,
so dat yu go fit live betta life.
21Raitious pipol and doz wey get respet
go stay for di land wey bi awa own.
22But just as dem dey rut plant komot for groun,
na so God too go porshu wiked pipol
kon rut sinnas komot from di land.
Currently Selected:
Proverbs 2: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

:
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee