Proverbs 24
24
Di Nineteent Word
1Make yu nor jealous evil pipol
or try to make friend with dem,
2bikos na only trobol dem dey always tink about
and anytin wey dem tok, dey kause wahala.
Nomba Twenty Word
3Na wisdom pesin dey take build house,
but na undastandin go make am stand
4and na knowledge dem take
dey dekorate am with fine and betta tins.
Nomba Twenty-one Word
5To dey wise, betta pass to dey strong!
Yes, wisdom betta pass pawa.
6So make sure sey yu plan well before yu go fight
and di more dem advise yu well,
di more yu go dey win.
Nomba Twenty-two Word
7Wise word too deep for foolish pipol to undastand.
So wen ever pipol dey tok about sirious matter,
foolish pipol nor get any betta tin to tok put.
Nomba Twenty-three Word
8If yu dey always plan evil,
na trobol-maker dem go dey koll yu,
9bikos anytin wey foolish pesin plan,
dey make pesin sin and pipol
nor like pesin wey dey laf odas.
Nomba Twenty-four Word
10If yu faint for di day wen wahala kom,
dat one go show sey yor strent small well-well.
Nomba Twenty-five Word
11Kwik save doz wey dem won kill
for wetin dem nor do.
12If yu fit sey e nor koncern yu,
God know and dey judge evritin wey yu dey do.
E dey look yu and E know yu well-well.
E go reward yu akordin to wetin yu do.
Nomba Twenty-six Word
13My pikin, make yu chop honey bikos e good.
Just as honey sweet for yor mout,
14na so wisdom dey good for di soul.
Make yu get wisdom
and yor future go dey sikure.
Nomba Twenty-seven Word
15Make yu nor bi like wiked pipol
wey dey plan to tif from good pipol or break enter dia house,
16bikos no matter how many times good pipol fall;
dem dey always get up again;
but trobol dey distroy wiked pipol.
Nomba Twenty-eight Word
17Make yu nor dey happy if yor enemies enter trobol
and nor rijoice wen dem fall,
18bikos God go know if yu dey happy and E nor go like am;
den E fit nor kon ponish dem again.
Nomba Twenty-nine Word
19Make yu nor fear doz wey dey do evil
and make yu nor jealous wiked pipol at-all,
20bikos wiked pesin nor get betta future
and dem nor dey hope for anytin again.
Nomba Thirty Word
21So my pikin, make yu fear God and honor di king.
Make yu nor do anytin with pipol wey dey tok against dem,
22bikos God fit distroy dat kind pipol wons
and who know di wahala wey God
and di king fit kause for dem?
Oda-wise Word
23Wise pipol still tok dis tins too:
E bad well-well if judge nor dey judge well for kourt.
24If di judge sey na di pesin wey do wrong dey innocent,
evribody go curse and hate am.
25Judge wey dey ponish pesin wey do wrong,
go prosper and get good name,
26bikos, honest ansa na good sign for true friendship.
27Before yu build yor house,
make sure sey yu don prepare and ready yor farm for work.
28Nor tok against anoda pesin without good rizin
or tok yeye tins about pipol.
29Nor boast sey, “I go do am back wetin e do mi.
Yes! I go deal with am well-well.”
30Wen I waka pass foolish and lazy pesin
farm and vineyard,
31na shuku-shuku and grass grow full am.
Di wall wey dem build round am,
don fall rish groun.
32I look kon tink
and I kon learn lesin from am sey:
33Make yu sleep and rest as yu like
or fold yor hand and rest small,
34but make yu remember sey, as yu dey sleep,
poverty go kom attack yu like tif.
Currently Selected:
Proverbs 24: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee