Proverbs 13
13
1Pikin wey get sense dey listin to en papa and mama word,
but doz wey dey foolish, nor dey take korreshon.
2Wise word go put betta food for yor tabol,
but na only wahala wiked pipol go chop.
3Doz wey dey kontrol dia tongue go get long life,
bikos anyhow word dey distroy tins.
4Lazy pipol won get plenty,
but na small dem dey get,
while doz wey dey work hard, dey prosper.
5Doz wey dey fear God nor like lie;
but na only shame and disgrace wiked pipol dey kause.
6Na God dey guide innocent pipol,
but na sin dey kontrol wiked pipol.
7Poor pipol dey bihave like sey dem get money,
but doz wey get money dey pritend sey dem poor.
8Rish pipol fit pay anytin for dia life,
but nobody dey treaten poor man.
9Doz wey dey fear God, na lite and joy full dia body,
but wiked pipol lite go soon kwensh.
10To dey karry body up, dey kause wahala,
but doz wey dey take advise, wise well-well.
11Money wey pesin play wayo take get kwik-kwik, dey disappear,
but di one from hard work dey last forever.
12Wen wetin pesin hope for nor kwik rish en hand, di heart go sick,
but dream wey kom to pass, bi like tree wey dey give life.
13Pipol wey nor dey listin to advise dey ask for trobol,
but doz wey dey respet di law, go susid.
14Wise pipol word bi like wota wey dey give life
and doz wey asept am, dey run from deat.
15Dem dey respet pesin wey get sense,
but sturbon pipol go distroy demsef.
16Wise pipol dey tink before dem do anytin,
but foolish pipol nor dey tink
and dem dey happy sey dem foolish.
17Na manaja wey nor get sense dey enter trobol,
but betta manaja dey bring progress.
18If yu vex sey pipol dey korrect yu,
na poverty and disgrace go end yor life;
but dem go honor yu, if yu asept korreshon.
19If pesin get wetin e wont, e dey sweet am well-well,
but na only fool nor dey gri stop di wiked tins wey e dey do.
20Follow who get sense waka, so dat yu go get sense too;
but if yu waka with foolish pipol, na trobol go follow yu.
21Doz wey dey like to sin, na trobol dey porshu dem,
but na blessing, raitious pipol go gain.
22Good pipol dey leave propaty for dia grand-shidren,
but na doz wey dey fear God dey take evritin
wey wiked pipol die leave.
23Poor pesin farm fit produce many food,
but wikedness dey make dem disappear.
24Doz wey nor dey korrect dia shidren, hate dem.
But doz wey love dia shidren, dey always korrect dem with love.
25Doz wey dey fear God, go get enough food to chop,
but na honga go kill wiked pipol.
Currently Selected:
Proverbs 13: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee