Proverbs 12
12
1Pesin wey dey happy wen dem korrect am, get wisdom,
but anybody wey dey vex wen dem korrect am, nor get sense.
2God dey happy with good pipol,
but E dey kondemn doz wey dey plan wiked tins.
3Wikedness nor dey pay pesin,
but nor-tin dey shake good pipol.
4Good wife dey bring joy and pride to en husband;
but wife wey dey bring shame for en husband
bi like diziz for en bone.
5Good pipol dey always tink good,
but make yu nor ever trust anytin wey wiked pipol tell yu.
6Wiked pipol word dey kill,
but raitious pipol word dey save pipol.
7Wiked pipol dey die trowey,
but doz wey dey fear God, dey get long life.
8Dem dey praiz pesin wey get sense,
but nobody dey respet wiked pesin.
9E betta make yu bi ordinary pesin wey dey work to chop,
dan to dey karry body up wen yu nor even get garri to soak.
10Raitious pipol dey kare for dia animals,
but wiked pipol dey trit dia own anyhow.
11Pesin wey dey work hard, always get plenty to chop,
but pesin wey dey porshu dis world tins, nor get sense.
12Pipol wey bi tif dey jealous wetin odas tif,
but wetin raitious pipol get, dey rish dem,
bikos dem dey work for dia own food.
13Wiked pipol words dey put dem for wahala,
but raitious pipol go eskape from trobol.
14Wise word get gain
and hard work dey bring reward.
15Foolish pipol dey always tink sey wetin dem dey do dey korrect,
but wise pipol dey listin to odas.
16Foolish pipol dey kwik vex,
but wise men nor dey tok even wen dem curse dem.
17Good witness dey tok trut,
but wiked pipol dey always lie.
18Foolish pipol dey tok anyhow,
but wetin wise pipol tok, dey heal many wound.
19Trut go last forever,
but lie-lie nor dey tey before evribody go know sey na lie.
20Pesin wey dey tink so-so bad-bad tins, na wikedness full en heart,
but doz wey like peace, get joy for dia life.
21Wahala nor fit kom meet doz wey dey fear God,
but na trobol dey always follow wiked pipol.
22God hate pipol wey dey lie,
but E like doz wey dey tok trut.
23Wise pipol nor dey karry body up,
but foolish pipol dey show dia foolishness.
24Na only doz wey work hard go fit lead odas,
but lazy pipol go bi slave.
25If pesin dey worry, e go make am sick,
but betta word go make yor body strong again.
26Doz wey dey fear God dey advise dia friends well,
but wiked pipol dey lead dem enter wahala.
27Lazy pipol nor even fit kook di animal wey dem katch,
but doz wey get sense, dey use evritin wey dem get, well.
28Doz wey dey follow God, go get life
and dis way wey dem dey follow, nor dey kause deat.
Currently Selected:
Proverbs 12: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: