YouVersion Logo
Search Icon

Proverbs 11

11
1God hate pipol wey dey play wayo,
but E dey love doz wey dey do good tins.
2E good to dey honest,
but na disgrace go follow proud pipol.
3Na trut dey guide yu if yu dey good;
but pipol wey dem nor fit trust, na dia own wayo dey distroy dem.
4Wen God won judge yu, yor money and propaty nor go fit help yu,
but na to obey God bi di only tin wey go fit save yor life.
5Pesin wey dey good dey always do good tins,
but if yu dey do wiked tins, na yor own sin go distroy yu.
6Raitiousness dey save doz wey dey tok trut,
but doz wey dem nor fit trust, na dia own bad plans, dey kill dem.
7Wen wiked pipol die, dia hope dey die with dem,
bikos dem bilive on dia own pawa.
8Pipol wey dey raitious, God dey protet dem from trobol;
but trobol dey always follow wiked pipol.
9Doz wey nor know God, wetin dem dey tok, fit distroy pesin,
but di sense wey raitious pipol take dey tok, go save life.
10Just as pipol dey happy wen good pesin dey prosper,
na so too dem dey happy wen wiked pesin die.
11E go betta for any town wey raitious pipol bless;
but wiked pipol words go distroy am.
12E too tok bad about odas, but if yu get sense,
yu go fit kontrol yor mout.
13Pesin wey dey judge anoda pesin, nor go fit keep sekret,
but yu fit trust pesin wey dey tok trut.
14Any nashon wey nor get who dey guide am, go fall,
but wen doz wey dey give yu good advise many, yu go prosper.
15Trobol dey follow who promise to pay di money wey strenja owe.
So, e betta if yu nor put yorsef for di matter at-all.
16Dem dey respet woman wey dey respet pipol,
but even with all di propaty wey wiked men get,
nobody dey respet dem.
17Pesin wey good dey gain favor for ensef;
but wiked pipol dey bring trobol for diasef.
18Wiked pipol nor get gain for anytin,
but reward dey for who dey do di korrect tin.
19Anybody wey ready to live rite, go get life;
but pesin wey sey na bad tins e like to dey do, go die.
20God hate pipol wey get bad mind,
but E love doz wey dey do di rite tin.
21Make yu know sey God go ponish wiked pipol;
but na betta judgement go follow raitious pipol.
22Fine woman wey nor get sense,
bi like ring wey dem put for pig nose and mout.
23Wetin good pipol wont, dey bring good result;
but evribody dey vex if wiked pesin get wetin e wont.
24Wen pipol give out dia money, dem dey get more;
but doz wey nor dey give, nor dey get at-all.
25Make yu dey give and yu go prosper;
help odas and yu go get help.
26Pipol go curse di pesin wey store en korn
dey wait who go buy am for high prize;
but dem go praiz doz wey sell am for di normal prize.
27Dem go respet yu if yu get good mind;
but if yu dey look for trobol waka, na trobol go follow yu.
28Doz wey trust dia propaty,
go fall like wetin harmattan breeze blow;
but raitious pipol go prosper well-well,
dem go bi like sun wey dey shine.
29Pesin wey bring trobol kom meet en family,
nor go get anytin
and foolish men go always bi savant to wise pipol.
30Raitious pipol fruit bi like tree wey dey give life,
but pesin wey dey prish give odas to turn kom meet God, get sense.
31Doz wey good, dey get dia reward for dis world,
but na ponishment go follow pipol wey dey sin and do wiked tins.

Currently Selected:

Proverbs 11: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in