YouVersion Logo
Search Icon

Nombas 33

33
Journey From Egypt To Sinai
1Dis na di place dem wey Israel pipol travel go, afta dem komot from Egypt akordin to dia tribe, just as Moses and Aaron kommand dem. 2Akordin to God kommand, Moses kon rite di names of each place wey dem stay.
3Israel pipol komot from Egypt for di fifteent day for di first mont wey bi di day afta di Passova. For Egypt pipol present, dem kon komot from Rameses town and God guide dem. 4Naw, Egypt pipol beri all dia first-born pikin wey God kill and God still ponish dia juju.
5Israel pipol travel from Rameses go Sukkot.
6From Sukkot, dem go Etam wey dey klose to di wildaness.
7Dem travel from Etam go Pi Hahirot wey dey before Baal-Zefon and dem kon stay near Migdol.
8From Pi Hahirot dem travel pass di middle sea go di wildaness kon use three days travel go Etam Wildaness for Marah.
9Dem travel from Marah go Elim; twelf wota fountain and seventy palm tree dey for Elim, so dem kon stay der.
10Dem travel from Elim go stay near di Red Sea.
11Den from di Red Sea, dem travel go Zin Wildaness.
12From Zin Wildaness, dem go Dofkah.
13And from Dofkah, dem travel go Alush.
14Dem komot from Alush kon travel go Refidim, where wota nor dey for di pipol to drink
15and from Refidim, dem kon go Sinai Wildaness.
Waka For Di Wildaness
16Dem travel from Sinai Wildaness go stay Kibrot Hattaavah.
17From Kibrot Hattaavah, dem kon go Hazerot and
18from Hazerot, dem travel go stay Ritmah. 19From Ritmah, dem travel go Rimon-Perez. 20Dem travel from Rimon-Perez go Libnah. 21From Libnah, dem kon travel go Rissah. 22Dem travel from Rissah go Kehelatah. 23Den dem kon travel from Kehelatah go Mount Shefa. 24Dem travel from Mount Shefa go Haradah. 25From Haradah, dem kon travel go Makhelot. 26Dem travel from Makhelot go Tahat. 27From Tahat, dem kon go Terah. 28Dem travel from Terah go Mitcah. 29And from Mitcah, dem travel go Hashmonah. 30Dem travel from Hashmonah go Moserot 31kon from Moserot go Bene Jaakan. 32Dem travel from Bene Jaakan go Hor Haggidgad 33kon travel from Hor Haggidgad go Jotbatah. 34Dem travel from Jotbatah go Abrona. 35From Abrona, dem kon go Ezion-Geber. 36Dem travel from Ezion-Geber go Zin Wildaness, wey bi Kadesh.
From Kadesh To Moab
37Dem travel from Kadesh go Mount Hor wey dey near Edom. 38Aaron di priest klimb Mount Hor akordin to God kommand and e die for der for di nomba forty years wey Israel pipol komot from Egypt land for di first day for di fift mont. 39Naw Aaron na one hundred and twenty-three years wen e die for Mount Hor. 40Arad and Kanaan pipol kings wey dey stay for di sout-side for di land wey dey Kanaan kon hear sey Israel pipol dey kom. 41Dem travel from Mount Hor go Zalmonah. 42From Zalmonah, dem travel go Punon 43and from Punon, dem kon go Obot. 44Dem travel from Obot go Iye-Abiram, wey dey near Moab. 45Dem travel from Lim go Dibon 46kon from der travel go Almon-Diblataim. 47Dem travel from Almon-Diblataim go Abarim Mountin before Nebo. 48Dem from Abarim Mountin go Moab plain land near Jordan River for where dem dey cross go Jeriko. 49Dem kon stay for Jordan River, from Bet-Jeshimot go rish Abel-Shittim for Moab.
Kanaan Borda
50God tell Moses for Moab near Jordan River wey dey di oda side for Jeriko: 51“Make yu tell Israel pipol sey, ‘Wen una don cross komot from Jordan River go Kanaan land, 52una must drive all di pipol wey dey stay di land komot. Make una distroy all dia juju wey dem make with stone or iron and all di place where dem for dey woship di juju. 53Una must drive all di pipol wey dey stay der komot kon stay for di land, bikos I don gi-am to una. 54Make una divide di land akordin to di tribe and family wey dey among una. Make una give big propaty to di family wey plenty and small propaty to di family wey nor plenty. 55But if una nor drive di pipol komot, den dem go dey give una problem and dem go trobol una for di land. 56If una nor drive dem komot, I go distroy una, just as I plan to distroy dem.’ ”

Currently Selected:

Nombas 33: pcm

Highlight

Copy

Compare

Share

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in

Video for Nombas 33