Nombas 3
3
Aaron Sons
1Dis na both Aaron and Moses family afta God tok with Moses for Mount Sinai. 2Dis na Aaron sons name; di first pikin na Nadab, den Abihu, before Eleazar and den Itama. 3Aaron wey dem choose as priest to serve God, dis na di sons wey e born kon make dem priests. 4Nadab and Abihu die for God present wen dem give wetin nor dey klean to God for Sinai Wildaness and dem nor get shidren. So Eleazar and Itama kon dey work as priest for where Aaron wey bi dia papa dey.
Levi Pipol Work
5God tell Moses: 6“Make yu bring Levi pipol and make dem bi savant to Aaron wey bi di priest. 7Dem go dey do di work wey dem suppose do for di tent, for di priest and for all di pipol. 8Dem go kare for evritin wey dey inside di tent and for Israel pipol. 9Di only work wey Levi pipol get to do, na to serve Aaron and en sons. 10So yu go choose Aaron and en sons kon make dem do di work wey priests dey do; anybody wey try to do dia work for dem, make dem kill-am.”
11Den God tell Moses: 12“Si, I don use Levi pipol take replace all di first-born for Israel. So na mi get Levi pipol, 13bikos all di first-born na my own. Wen I kill all di first-born for Egypt, I keep all di first pikin for Israel for mysef, so both man and animal na my own. Na mi bi Oga God.”
Levi Pipol
14Den Oga God tell Moses for Sinai Wildaness sey: 15“Make yu kount Levi pipol akordin to dia town and family. Evry boy pikin from one mont go, naim yu go kount.” 16So Moses kount dem just as God kommand am.
All Di Family
17Dis na Levi sons akordin to dia names:
Gershon, Kohat and Merari.
18Dis na Gershon sons name akordin to dia family:
Libni and Shimei.
19Kohat sons akordin to dia family na:
Amram, Izhar, Hebron and Uzziel.
20Merari sons akordin to dia family na: Mahli and Mushi.
All dis na Levi pipol akordin to dia family.
Gershon Pipol
21Na Gershon born Libni and Shimei pipol and na dem bi Gershon family. 22Doz wey dem kount, plus di sons wey dem kount from one mont go, na 7,500. 23Gershon family go stay for di west side wey dey di Tabanako back yard. 24Di pesin wey dey lead Gershon pipol, na Eliasaf wey bi Lael pikin. 25Di work wey Gershon pipol go do for di tent na to kare for di Tabanako, di tent kover; both for inside and outside, di curtain wey dey di tent gate where dem for dey do meetin, 26di curtains for di kourtyard, di curtain for di kourtyard front for di Tabanako and di altar with di ropes and evry oda tin wey dem dey use for der.
Kohat Pipol
27Na Kohat born Amram, Izhar, Hebron and Uzziel family. 28Doz wey dem don kount, plus di sons wey dem kount from one mont go, na 8,600. 29Na dem go kare for di Holy Place. Kohat family go stay near di sout-side for di Tabanako. 30Di pesin wey dey lead dem na Elizafan wey Uzziel born. 31Dia work na to kare for di box, tabol, lampstand, di altars and di tools wey di priest dey use for di Holy Place. Dia work na to kare for evritin wey dey dia list. 32Naw, di pesin wey dey lead all di leaders for Levi tribe, na Eleazar wey Priest Aaron born. So dem choose am to supavise doz wey dey work for di Holy Place.
Merari Pipol
33Na Merari born Mahli and Mushi family. 34Doz wey dem don kount, plus di sons wey dem kount from one mont go, na 6,200. 35Di pesin wey dey lead dem na Zuriel wey Abihail born. Dis pipol go stay near di nort side for di Tabanako. 36Di work wey dem give Merari pipol join di frame for di Tabanako, na to kare for di cross bar, post, socket, tools and all di work wey dem dey do with dis tins. 37Di pilas for di kourt wey round am with dia socket, dia peg and dia ropes.
38But di pipol wey go stay for di Tabanako front for east wey face di tent where dem for dey do meetin, na Moses, Aaron and en sons. Na dem go kare for di tins wey dem nid for di Holy Place and wetin Israel pipol wont. But if anybody wey nor suppose go der, go der, dem go kill-am.
39All di pipol wey Moses and Aaron kount wey kom from Levi akordin to dia family and di word wey God tok, plus di sons wey dem kount from one mont go, na 22,000 dem bi.
First-born
40Den God tell Moses, “Make yu kount all di first sons for Israel, from one mont go kon know dia names. 41But Levi pipol must keep all dia first-born wey bi man for mi! Na mi bi Oga God! Na mi get all di first pikin wey Levi pipol animal go born. So I go take Levi first sons and animals as my own kon leave di rest tribes.”
42So Moses kount all di first sons for Israel, just as God kommand am. 43And evry first son wey dem kount from one mont go na 22,273.
44Den God tell Moses: 45“Make yu take Levi pipol instead of all di first-born for Israel, den all di first-born wey Levi pipol animal go born, make yu give dem to mi, instead of all di first-born wey di whole Israel animal go born. Levi pipol go bi my own. Na mi bi Oga God. 46Israel pipol first sons use 273 take plenty pass Levi pipol own, so yu must buy di remainin shidren back. 47For each one, yu go pay five pieces for silva, akordin to di money wey dem dey kollect for di Holy Place. 48And una go give dis money to Aaron and en sons.”
49So Moses kollect silva kon buy di first-born for Israel back wey many pass Levi own. 50E kollect 1,365 pieces for silva to take buy di first-born for Israel (each of di money na as dem dey measure am with di sanctuary shekel). 51Den e take di money go give Aaron and en sons, just as God kommand am.
Currently Selected:
Nombas 3: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: