Nombas 2
2
Di Tribes
1God kon tell Moses and Aaron: 2“Evribody for Israel must stay with en family; dem must stay near di tent where dem for dey do meetin.”
Di Tribe For East
3Naw, di pipol wey stay for east, where di sun for dey raiz, na Judah pipol, just as e suppose bi. Di pesin wey dey lead Judah pipol, na Nahshon, wey bi Amminadab pikin. 4Di pipol wey dem kount for dis group na 74,600.
5Doz wey stay klose to dem na Issakar tribe. Di pesin wey dey lead Issakar pipol, na Netanel wey Zuar bi en papa. 6Di pipol wey dem kount for dis group na 54,400.
7Di oda one na Zebulun tribe. Di pesin wey dey lead Zebulun pipol na Eliab wey bi Helon pikin. 8Di pipol wey dem kount for dis group na 57,400.
9All di pipol wey dem kount for Judah wey stay akordin to dia group, na 186,400. Na dem go travel for front.
Di Tribe For Sout
10For di sout, doz pipol wey dey under Reuben tribe, stay akordin to dia group and di pesin wey dey lead Reuben pipol, na Elizur wey en papa na Shedeur. 11Di pipol wey dey under Reuben tribe na 46,500.
12Di pipol wey go stay near dem, na Simeon tribe. Di pesin wey dey lead Simeon pipol na Shelumiel wey Zurishaddai born. 13Di pipol wey dey under Simeon tribe na 59,300.
14Di next pipol na Gad tribe. Di pesin wey dey lead dem na Eliasaf wey bi Deuel pikin. 15Di pipol wey dey under Gad tribe na 45,650.
16All di pipol wey dey Reuben kamp akordin to dia group na 151,450. Na dem bi di sekond group to travel.
Di Tribe For Centre
17Between di first group and di sekond group, na Levi pipol go waka for dia centre and dem go karry di tent. Dem go travel just as dem kamp, evry group akordin to en own place under en family name.
Di Tribe For West
18Di group for west na Efraim tribe. Di pesin wey dey lead dem na Elishama wey Ammihud born. 19Di pipol wey dey under Efraim tribe na 40,500.
20Di pipol wey go stay near dem na Manasseh tribe. Di pesin wey dey lead dis group na Gamaliel wey Pedahzur bi en papa. 21Di pipol wey dey under Manasseh tribe na 32,200.
22Di pipol wey go stay near dem na Benjamin tribe. Di pesin wey dey lead dis group na Abidan wey Gideoni born. 23Di pipol wey dey under Benjamin tribe na 35,400.
24All di pipol wey dey Efraim tribe akordin to dia group, na 108,100. Na dem go bi di third group to travel.
Di Tribe For Nort
25Di group for nort na Dan tribe. Di pesin wey dey lead di group na Ahiezer wey Ammishaddai born. 26Di pipol wey dey under Dan tribe na 62,700.
27Di pipol wey go stay near dem na Asher tribe. Di pesin wey dey lead di group na Pagiel wey bi Okran pikin. 28Di pipol wey dey under Asher tribe na 41,500.
29Di pipol wey go stay near dem na Naftali tribe. Di pesin wey dey lead di group na Enan pikin, Ahira. 30Di pipol wey dey under Naftali tribe na 53,400.
31All di pipol wey dey Dan kamp, na 157,600. Na dem go travel last, just as dem arrange am.
Konklusion
32Israel pipol wey dem kount akordin to dia group na 603,550. 33But dem nor kount Levi pipol join, bikos God don kommand Moses sey na so e go bi. 34So Israel pipol do all wetin God tell Moses; na so dem kamp under dia family name kon travel; each pesin with en tribe and family.
Currently Selected:
Nombas 2: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: