Nombas 21
21
Israel Pipol Win Hormah
1King Arad for Kanaan wey dey stay Negev, hear sey Israel pipol dey kom from Atarim, so e kon attack and kapture some of dem. 2Den Israel pipol kon make vow to God sey: “If Yu diliver dis pipol give us, wi go distroy dia town.” 3God hear Israel pipol prayer kon diliver Kanaan pipol to dem and dem distroy dem and dia towns. So dem kon koll dat place, “Hormah.”
Di Snake
4Den dem travel from Mount Hor near di Red Sea, go round Edom land, but di pipol kon dey hurry anyhow for road. 5Di pipol tok against God and Moses sey, “Why Yu take us komot from Egypt make wi for die for dis wildaness wey bread or wota nor dey and wi don taya for dis yeye food.”
6So God send snake go bite di pipol and dem many wey die. 7Den di pipol go meet Moses kon sey, “Wi don sin, bikos wi don tok against God and yu. Make yu pray to God make E take di snake komot from where wi dey.” So Moses kon pray for di pipol.
8God tell Moses, “Make yu make snake put on-top pole and anybody wey snake bite wey look am, nor go die.” 9So Moses make snake with bronze kon put am on-top pole, so dat di pipol wey snake bite, if dem look di snake wey dem make with bronze, dem nor go die.
Moab Pipol
10Israel pipol travel kon kamp for Obot. 11Den dem travel from Obot go stay for Iye-Abiram, for di wildaness wey dey before Moab, for di east side. 12From der, dem kon travel go kamp for Zered Valley. 13Den dem travel from der go di oda side for Amor for di wildaness wey wide from Amor, bikos Arnon na Moab borda wey dey between Moab and Amor. 14Dis na why dem rite for God War Book sey,
“Waheb town wey dey Sufah aria and di valleys;
Arnon river, 15di low valley
wey rish Ar town
klose to Moab boundary.”
16So from der, dem kon go Beer; dat na di well where God for tok to Moses sey, “Make yu gada di pipol and I go give dem wota.”
17Den Israel pipol kon sing dis song:
“Make dis well kom up
kon sing to God!
18Di well wey di princess dig,
wey di leaders open
with dia septa and staff.”
Dem travel from di wildaness go Mattanah; 19from Mattanah to Nahaliel and from Nahaliel to Bamot. 20Dem still travel from Bamot go di valley wey dey Moab kountry, on-top Pisgah wey face di wildaness.
King Sihon And King Og
21Den, Israel pipol send messenja go meet King Sihon wey dey rule Amor sey,
22“Make yu allow us pass yor land; wi nor go-go di field or vineyard; wi nor go drink wota from yor well, but wi go stay for di main road until wi don komot from yor aria.”
23But King Sihon nor gri make Israel pipol pass en aria; instead e gada all en sojas kon go attack Israel pipol for di wildaness. Wen e rish Jahaz, e kon fight against Israel pipol. 24But Israel pipol kill dia enemy well-well kon take di land from Arnon River for nort go rish Jabbok and Ammon side, but Ammon sojas bin guide dia aria well-well. 25So Israel pipol take all dis towns kon stay for Amor, Heshbon and dia village dem. 26Heshbon na King Sihon town for Amor. Naw, e don fight against di king wey dey Moab before kon take all en land from der go rish Arnon.
27Dis na why dem sey,
“Make yu kom Heshbon,
so dat dem go build am.
Make dem build
King Sihon town again!
28Bikos fire kom out from Heshbon,
betta fire kom out from Sihon town.
E don distroy Ar wey dey Moab
and di ogas wey dey for Arnon.
29Moab pipol, curse dey una head.
Kemosh pipol, una don skata!
Una make una sons dey run anyhow
and una dotas don turn King Sihon
for Amor, prisonas.
30Wi don ova pawa dem;
from Heshbon go rish Dibon
and all dia pipol don die finish.
Wi don skata dem go rish Nofah
wey dey near Medeba.”
31So Israel pipol kon dey stay for Amor pipol land. 32Moses send men make dem go find di best way to attack Jazer town. Israel pipol katch di town, drive Amor pipol kon dey stay der. 33Den, Israel pipol turn go pass di road wey lead to Bashan. King Og for Bashan kon go attack Israel pipol for Edrei.
34God tell Moses, “Make yu nor fear am. I go make yu win en, all en pipol and en land. Make yu do to am wetin yu do King Sihon, di Amor king wey bin dey rule for Heshbon.”
35So Israel pipol win and kill King Og, en sons and all en pipol, until nobody dey to kill again, den dem kon stay for en land.
Currently Selected:
Nombas 21: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee