YouVersion Logo
Search Icon

Nombas 20

20
Israel Pipol Komplain Again
1For di first mont, di whole kommunity for Israel go Zin Wildaness kon stay for Kadesh. For der, Miriam die and dem kon beri am.
2Wota nor dey, so di pipol kon gada round Moses and Aaron 3dey komplain sey: “E for betta sey all of us die for di tent for God present! 4Wetin make yu bring us kom dis wildaness, so dat wi go die with awa animals? 5Why yu take us komot from Egypt kom dis evil place where nor-tin dey grow? No korn, fig, grape or pomegranate fruit for here. Wota to drink sef nor even dey!”
Moses Ansa
6Moses and Aaron komot from di pipol front go enter di tent. Dem bow face groun and God glory kon appear to dem. 7God tell Moses, 8“Make yu take di stik and yu and Aaron yor broda go gada di kommunity, den tok to di rock for dia front and wota go kom out. Like dis yu go bring wota out from rock for di pipol, both for dem and dia animals.”
9So Moses take di stik from God present, just as God kommand am. 10En and Aaron kon gada di whole kommunity for di rock front, den Moses sey, “Make una listin! Una wey sturbon well-well! Make wi bring wota out from rock for una?” 11Den Moses raiz en hand kon nak di rock two times with en stik. Plenty wota rush kom out, den evribody for Israel and dia animals kon drink beleful.
God Judgement
12Den God tell Moses and Aaron, “Bikos una nor trust mi well-well to show di pipol how I dey holy rish, una nor go take dem enter di land wey I dey give una.”
13Dis tin happen for Meribah where Israel pipol for komplain against God and God show dem how E dey holy.
Edom Pipol Nor Agri
14Moses kon send message from Kadesh go give Edom king sey:
“Di message na from yor broda Israel: Yu know all di sofa wey wi dey sofa, 15how awa grand-grand papa go Egypt where wi stay for many years. How Egypt pipol ponish us and awa grand-grand papa well-well. 16So wen wi kry to God, E hear awa vois kon send messenja, wey kom take us komot from Egypt.
Naw, wi dey Kadesh, di town wey dey una kountry side. 17Wi beg make una allow us waka pass una kountry. Wi nor go waka pass una field or vineyard. Wi nor go drink wota from any well. Wi go waka just as di king go tell us. Wi go stay for di main road until wi komot from una aria.”
18But Edom king ansa,
“Una nor go fit waka pass awa kountry, if una try am, wi go attack una.”
19Israel pipol kon sey,
“Wi go stay for di main road and if any of us or awa animals drink yor wota, wi go pay for am, wi just won waka pass.”
20But Edom ansa,
“Una nor go fit waka pass.”
Den Edom kom out kon attack Israel pipol with plenty sojas. 21Edom nor gri make Israel pipol waka pass, so dem kon waka pass anoda place.
Aaron Die
22So di whole kommunity for Israel komot from Kadesh go Mount Hor. 23And God tell Moses and Aaron for Mount Hor, near Edom borda sey, 24“Aaron nor go enter di land wey I promise to give Israel pipol; e go die, bikos una nor gri obey my kommand for Meribah. 25Make yu take Aaron and Eleazar en pikin kom Mount Hor. 26Den remove Aaron priest klot kon wear am for Eleazar, bikos Aaron go die for der.”
27Moses do wetin God kommand am. Dem kon go Mount Hor for di whole kommunity present. 28Den Moses remove Aaron priest klot kon wear am for Eleazar. Aaron die on-top di mountin, den Moses and Eleazar kon kom back. 29Di whole kommunity know sey Aaron don die, den dem kon mourn for am for thirty days.

Currently Selected:

Nombas 20: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in

Video for Nombas 20