YouVersion Logo
Search Icon

Nombas 13

13
Pipol Wey Go Spy
1God tell Moses: 2“Make yu send men go shek Kanaan land wey I won give Israel pipol. Yu go send one man from each of di twelf tribe. Make each one bi leader for en tribe.” 3So Moses send dem komot from Paran Wildaness, just as God kommand. All di men wey e send, na leaders for Israel. 4Na dia names bi dis:
From Reuben tribe, e send Shammua wey Zakkur born;
5from Simeon tribe, e send Shafat wey Hori born;
6from Judah tribe, e send Kaleb wey Jefunneh born;
7from Issakar tribe, e send Igal wey Josef born;
8from Efraim tribe, e send Hoshea (Joshua) wey Nun born;
9from Benjamin tribe, e send Palti wey Rafu born;
10from Zebulun tribe, e send Gaddiel wey Sodi born;
11from Josef tribe (wey bi Manasseh tribe), e send Gaddi wey Susi born;
12from Dan tribe, e send Ammiel wey Gemalli born;
13from Asher tribe, e send Setur wey Mikael born;
14from Naftali tribe, e send Nahbi wey Vopshi born;
15from Gad tribe, e send Geuel wey Maki born.
16Dis na di men wey Moses send go shek di land. Hoshea wey Nun born, Moses kon shange en name to Joshua.
How Dem Take Spy
17Wen Moses send dem go shek Kanaan land, e tell dem, “Make una go thru Negev and all di hill kountries 18and si wetin di land bi like. Weda di pipol wey dey stay der strong or weak, small or plenty, 19or weda di land dey good or bad; weda di towns wey dem dey stay bi like kamp or betta town; 20weda di land dey rish or poor; get forest or not. Make una dey strong kon bring some fruit wey dey di land kom.” Naw, dis na di time for di year wen di first grape dey ripe.
Di Spy Work
21So dem kon go shek di land from Zin and Rehob Wildaness, where dem dey pass enter Lebo-Hamat. 22Wen dem pass thru Negev, dem kon rish Hebron for Ahiman, Sheshai and Talmai, where Anak shidren-shidren dey stay. (Naw, dem don build Hebron seven years before dem build Zoan for Egypt.) 23Wen dem rish Eshkol Valley, dem kon kut one branches wey grape full and two men karry am with stik. Dem still take some pomegranate fruit and fig follow body. 24Dem koll di place Eshkol Valley, bikos of di many grape wey Israel pipol kut from der. 25Den, dem kon kom back afta forty days, wen dem don shek di land.
Di Spy Ripot
26Dem kom back kom meet Moses, Aaron and Israel pipol for Paran Wildaness wey dey Kadesh kon tell dem evritin wey dem si and show dem di fruit wey dem bring from di land. 27Dem tell Moses, “Wi go di land wey yu send us. True-true, milk and honey full der and dis na di fruit wey dey der. 28But na strong and big pipol dey stay der and di town get betta wall and dem dey guide am well-well. Wi still si Anak shidren-shidren for der. 29Na Amalek pipol dey stay for di sout part for di land; na Hit, Jebus and Amor pipol dey di kountries for hill; Kanaan pipol dey near Mediterranean Sea and along Jordan River.”
30Den Kaleb tell di pipol sey make dem shut up kon sey, “Wi go attack naw kon take di land; wi dey strong and wi go fit konker di land.”
31But di men wey go with Kaleb kon sey, “No, wi nor strong rish to fight dem; di pipol wey dey der get pawa pass us.” 32So dem make Israel pipol bilive sey dem nor go fit konker di land wey dem go spy kon dey sey, “Di land nor go fit produce food for all di pipol wey dey stay der. All di pipol wey wi si der, big well-well 33and wi even si some giant for der (wey bi Anak shidren-shidren) and wi bi like ant for dia front.”

Currently Selected:

Nombas 13: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in