YouVersion Logo
Search Icon

Nombas 12

12
Miriam And Aaron Oppoz Moses
1Den Miriam and Aaron kon tok against Moses, bikos e go marry one woman from Ethiopia. 2Dem kon sey, “Na only thru Moses God dey tok to us? E neva still tok thru us too?” But God hear dem. 3(Naw, na Moses honbol pass anybody wey dey di eart.)
God Ansa
4At wons, God tell Moses, Aaron and Miriam sey: “Make una three kom meet mi for di Tabanako.” So dem kon go. 5God kom down inside kloud, stand for di tent gate; den E koll Aaron and Miriam and di two of dem waka go front. 6God tell dem, “Make una listin to mi:
“If anybody bi profet among una,
mi God go show mysef to am thru vishon
kon tok with am for dream.
7My savant Moses nor bi like dat;
e dey faithful for my house.
8So I go tok with am face-to-face
and nor bi with word wey e nor go undastand
and e go si as God bi.
So wetin make una nor dey fear
to tok against my savant Moses?”
9God kon dey vex with dem so E komot der. 10Wen di kloud komot di tent, leprosy kon full Miriam body like snow. Den Aaron look Miriam, kon si sey leprosy full en body!
Moses Beg For Dem
11So Aaron tell Moses, “My oga, abeg, nor let us sofa dis ponishment bikos of awa foolish sin. 12Nor let us mi bi like pikin wey don die, wey e flesh don rotin before dem born am.” 13Den Moses kry to God kon sey, “My God, abeg make Yu listin to am.” 14God tell Moses, “If to sey na en papa just spit for en face, dem nor go disgrace am for seven days? So make e komot form di kamp for seven days and afta, e fit kom back.” 15So dem porshu Miriam komot di kamp for seven days and di pipol nor travel until dem bring am kom back. 16Den di pipol komot from Hazerot kon go kamp for Paran Wildaness.

Currently Selected:

Nombas 12: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in