Mark 15
15
Jesus And Pilate
1For early morning afta dem don plan wetin dem go do Jesus, di priest oga dem with di law tishas and di Sanhedrin, tie am kon take am go meet Pilate.
2So Pilate ask Jesus, “Na yu bi di Jew pipol king?”
Jesus ansa, “Na as yu tok.”
3Den di priest oga dem still dey akuiz am, 4so Pilate ask Jesus again, “Yu nor get anytin to tok? Yu dey hear all dis tins wey dem sey yu do?”
5But Jesus nor tok anytin and dis tin kon sopraiz Pilate well-well.
Jesus and Barabas
6Anytime wen dem dey do di Passova Feast, Pilate always dey free one prisona wey di pipol ask for. 7Barabas, one man wey kill pesin for di time wey dem dey rayot, dey prison with pipol wey nor dey obey govment law. 8Den di pipol kom meet Pilate kon ask am sey, make e free one prisona for dem, as e dey do before.
9So Pilate ask dem, “Una wont make I free Jew pipol king for una?” 10(Pilate know sey di priest oga dem bring Jesus to am, bikos dem dey jealous). 11But di priest oga dem tell di pipol make dem ask Pilate make e free Barabas.
12So Pilate ask dem again, “Den wetin una wont make I do to dis man wey una koll Jew pipol king?”
13Dem kon shaut, “Kill-am trowey!”
14Pilate ask dem, “Why? Wish bad tin e do?”
But dem kon dey shaut more-more, “Kill-am trowey!”
15Bikos Pilate one do wetin di pipol wont, e kon free Barabas for dem, den afta e tell en sojas make dem flog Jesus, e kon give Jesus to di pipol make dem go kill-am.
Sojas Laf Jesus
16So di sojas push Jesus enter di varanda for di govnor palis kon koll evribody gada. 17Dem wear am purpol klot kon take shuku-shuku make crown wear for en head. 18Dem kon dey salot am, “Wi hail yu o-o, Jew pipol king!” 19Dem take stik nak am for head kon spit for en body. Dem knee down for en front dey bow for am. 20Wen dem don laf am finish, dem pul di purpol klot komot from en body kon wear am en own klot. Den, dem kon go kill-am.
Dem Nail Jesus For Cross
21Di sojas kon force Simon, one man from Sirene, wey just dey enter di town, make e karry Jesus cross. (Di man na Alexanda and Rufus papa.) 22Dem take Jesus go di place wey dem dey koll Golgota (wey mean, “Skull Place”). 23Dem gi-am wine wey dem mix with myrrh, but Jesus nor gri drink am. 24Dem nail am for cross kon divide en klot, dey trow dice make dem for know wetin go rish each pesin.
25Na nine oklok for morning dem take nail Jesus for cross. 26Dem kon rite sey, “Dis na Jew pipol king.” 27Dem nail two tif with am for cross, one for en left and di oda for en rite side. 28Wetin dem rite for God word kon happen sey, “Dem kount Jesus join bad pipol.” 29Pipol wey dey waka pass kon dey shake dia head and dey tok bad about am sey, “Eehen! Yu wey sey, yu go fit distroy di temple kon build am again for three days. 30Oya! Save yorsef make yu kom down from di cross!”
31Even di priest oga dem and di law tishas dey laf Jesus for where dem sidan, dey sey, “E save oda pipol, but e nor fit save ensef! 32Christ, wey sey e bi Israel king, make e kom down from di cross naw make wi si am, so dat wi go bilive!” Doz wey dem nail for cross with am kon dey curse am too.
Jesus Die
33Wen twelf oklok for aftanoon rish, darkness kon kover di kountry until three oklok for aftanoon. 34Around three oklok, Jesus kon shaut sey, “Eloi! Eloi! Lama Sabaktani?” Wey mean, “My God! My God! Wetin make yu abandon mi?”
35Wen some pipol wey stand near der hear wetin e tok, dem kon sey, “Listin. E dey koll Elijah!”
36Den one pesin run kom with foam kon soak am inside betta wine, den e put am for stik give Jesus make e drink, den e kon sey, “Make una leave am! Make wi si weda Elijah go kom save am.”
37But Jesus shaut again, den e kon die.
38So di curtain for di temple tear into two from top go rish bottom. 39Wen di soja wey stand for Jesus front si how e take die, e kon sey, “True-true dis man na God Pikin!”
40Some wimen dey der dey look from far. Dem bi Mary Magdalin, Mary wey bi Josef, James and Salome mama. 41For di time wen Jesus dey Galilee, dis wimen dey follow and help am. Many oda wimen wey follow am kom from Jerusalem, dey der too.
Jesus Burial
42Wen evening don rish for di day before di Sabat Day, 43Josef wey kom from Arimatea, wey bi Jew kansol memba, wey dey wait for God Kingdom and pipol dey respet am well-well, go meet Pilate kon ask for Jesus body. 44Pilate sopraiz sey Jesus don die. So e koll di soja kon ask am weda e don tey wen Jesus die. 45Wen Pilate hear wetin di soja tok, e kon sey make Josef go karry di body. 46Josef buy linen klot, bring Jesus body kom down from di cross kon take di klot wrap am, den e put am for grave wey dem dig inside rock. Den e roll big stone kover di grave mout. 47Mary Magdalin and Mary wey bi Josef mama dey look and dem si where dem beri Jesus put.
Currently Selected:
Mark 15: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: