Mark 14
14
Dem Plan Against Jesus
1Two days before Passova and di Bread wey nor get yist Feast, di priest oga dem and di law tishas kon dey find as dem go take arrest Jesus, make dem for kill-am. 2Dem sey, “Make wi nor do am naw wen dem dey do di Feast, so dat pipol nor go rayot.”
Mary Anoint Jesus For Betany
3Wen Jesus dey Betany for Simon house (wey get leprosy before), e sidan with dem to chop, naim one woman bring oil inside alabasta box kom, di oil dear well-well and dey send fine. Afta e don open di kontaina, e pour di oil for Jesus head.
4But some pipol wey dey der kon dey vex, dey tell each oda, “Why dis woman dey waste oil wey dear well-well like dis? 5Dem for sell am pass three hundred silva koins and give di money to poor pipol!” So, dem kon vex dey tok to di woman anyhow.
6But Jesus ansa dem, “Make una leave di woman alone. Why una dey wori-am? Na good tin e do for mi so o-o! 7Poor pipol go always dey with una and una go fit do good for dem anytime una like. But mi, I nor go dey with una always! 8Dis woman don do wetin e fit do. E anoint my body to prepare mi for beri before di time go rish. 9I tell una true word, anywhere wey dem go prish dis gospel for di whole world, pipol go tok about dis tin wey dis woman don do so.”
Dem Plan To Sell Jesus
10Den Judas Iskariot, wey dey among Jesus disciples, kon go meet di priest oga dem sey e won sell Jesus give dem. 11Wen dem hear am, dem happy well-well kon promise am money. So, Judas kon bigin find how e go fit take sell Jesus give dem.
Passova Feast
12Di day wen dem start di Bread wey nor get yist feast and wey dem dey sakrifice small sheep, Jesus disciples kon ask am, “Where yu wont make wi prepare for yu to chop Passova food?”
13Jesus send two disciples go for front kon tell dem, “Wen una enter di town, una go si one man wey karry wota kontaina. Make una follow am. 14Di house wey e go enter, make una tell di pesin wey get am sey, ‘Di Tisha sey make wi ask, “Where di room wey mi and my disciples go for chop Passova food?” ’ 15E go show una one big room for upstair where tabol and chairs dey. Make una prepare evritin for der.”
16So en disciples go di town and dem si evritin just as Jesus tell dem sey e go bi, dem kon prepare di Passova food for der.
17Wen evening rish, Jesus kon go di house with en twelf disciples. 18As dem dey chop for di tabol, Jesus kon sey, “I tell una true word, one of una wey dey chop with mi, go sell mi give my enemies.”
19Wetin Jesus tok kon dey worry di disciples for mind, so dem kon dey ask am one-by-one, “Oga God! Na mi?”
20Jesus ansa, “Na one of una wey dey follow mi chop for di same plate. 21Man Pikin go die as dem rite for God word about am, but curse dey di pesin head wey go sell am. E for betta sey dem nor born dat pesin at-all.”
Di Holy Kommunion
22As dem dey chop, Jesus take bread, tank God, den divide am give en disciples kon sey, “Make una take and chop, bikos dis na my body.”
23Afta, e take cup, tank God, den e give en disciples and all of dem, drink from inside.
24E kon tell dem, “Dis na my blood, di kovenant blood wey I pour for evribody. 25I tell una true word, I nor go drink wine again, until di day wen I go drink di new wine for God Kingdom.”
26Afta dem don sing one hymn, dem kon enter inside Mount Olives.
Jesus Sey Pita Go Deny Am
27Jesus kon tell en disciples, “Una go run leave mi, bikos God word sey,
“ ‘I go kill di pesin wey dey look di sheep
and di sheep go skata.’
28But afta God don wake mi up from deat, I go-go una front, go wait una for Galilee.”
29Pita kon sey, “Even if odas run leave yu, I nor go run leave yu o-o!”
30Jesus ansa am, “I tell yu di trut, today, for dis nite, before fawol go do ‘Kukuruku’ two times, yu go don deny mi three times.”
31But Pita still sey, “Even if I go die with yu, I nor go ever deny yu.” All of dem still tok di same tin.
Jesus Pray Inside Getsemani
32Jesus and en disciples kon go one place wey dem dey koll Getsemani and Jesus tell dem, “Make una sidan for here, bikos I won go pray.” 33E take Pita, James and John follow body. E mind kon dey trobol am and e nor dey happy. 34E kon tell dem, “My heart dey heavy well-well like sey I won die. So, make una stay here dey wosh.”
35E waka go front small kon fall face groun, bigin pray, “Papa! If yu wont, make yu let dis sofa pass mi.” 36Jesus kon pray, “My Papa, e nor get wetin yu nor fit do. Make yu take dis sofa cup from mi. But nor bi as I wont am, but na as yu wont.”
37Wen Jesus kom back, e meet en disciples dey sleep, so e tell Pita, “Simon, yu dey sleep? Yu nor fit stay make yu nor sleep for one hour? 38Make yu nor sleep, but dey pray make yu nor for fall enter temptashon. Man spirit won pray, but en body dey weak.”
39E komot again, go pray as e pray before. 40Wen e kom back again, e si sey dem still dey sleep; dem nor dey pray, so dem nor know wetin to tell am.
41E kom di third time kon ask dem, “Una still dey sleep? Di sleep don do, bikos time don rish! Make una si, dem don sell Man Pikin give sinnas. 42Make una get up make wi dey go. Si, di pesin wey won sell mi, dey kom!”
Dem Arrest Jesus
43As Jesus still dey tok, Judas, one of di twelf disciples kon kom with plenty pipol wey di priest oga dem, di law tishas and di eldas send and all of dem karry swod and big-big stik.
44(By dis time, di man wey won sell Jesus don give dem sign sey, “Di pesin wey I go kiss, naim bi di man. Make una arrest and hold am well-well.”) 45Wen Judas kom, e go meet Jesus kon sey, “Tisha!” Den e kiss am. 46So, di pipol kon seize and arrest Jesus. 47One pesin wey stand for der kon take en swod kut di High Priest savant ear komot.
48Jesus kon tell dem, “Na mi una karry swod and big-big stik kom arrest like sey I bi tif? 49I dey with una evriday for di temple dey tish, but una nor arrest mi den.” Dis tin happen so dat wetin dem rite for God word, go bi true. 50Den all en disciples kon run leave am.
51One yong man wey tie small klot for waist, dey follow Jesus. So dem won kon arrest di man join, 52but e kon run komot with nakednes and leave en klot for der.
Di Sanhedrin Kondemn Jesus
53Den, dem take Jesus go meet di High Priest, so all di priest oga dem, di eldas and di law tishas kon gada. 54Pita follow Jesus from far till e rish di High Priest varanda. E sidan with di guards dey warm en body near fire.
55Di priest oga dem and di Sanhedrin dey find wetin dem go take akuiz Jesus, so dat dem go fit kill-am, but dem nor si anytin. 56Many pipol lie for Jesus head and dem dey tok difren-difren tins, but dia story nor gri with each oda.
57Some pipol stand up kon lie against am sey, 58“Wi hear wen e sey, ‘I go distroy dis Temple wey dem build with hand and afta three days, I go build anoda one wey dem nor use hand build.’ ” 59All dia story nor dey good, bikos dem nor gri with each oda.
60Den di High Priest stand for dia front kon ask Jesus, “Yu nor get ansa? Wetin bi dis wey dem dey tok against yu so?” 61But Jesus kwayet and e nor ansa dem.
Den di High Priest kon ask am again, “Na yu bi Christ wey bi God Pikin?”
62Jesus ansa, “Na mi and yu go si Man Pikin sidan for God rite hand, wen e dey kom inside di kloud from heaven.”
63Den di High Priest tear en own klot kon sey, “Why wi dey find more pipol to tok for dis matter? 64Una don hear di word wey e tok against God! Wetin una tink sey make wi do am?”
Dem kon ansa, “E suppose to die.” 65Den some bigin spit for Jesus body, dem tie en eye kon dey nak am dey sey, “Profesai naw!” Di pipol wey dey guide di place still join beat am.
Pita Deny Jesus
66For dis time, Pita dey for di varanda, den di High Priest girl savant kom der. 67Wen e si Pita sidan dey warm ensef, e look am well-well kon sey, “Yorsef dey follow dat man wey kom from Nazaret, wey dem dey koll Jesus Christ.”
68But Pita deny kon sey, “I nor even know wetin yu dey tok about!” Den e waka go di gate and fawol kon do, “Kukuruku!”
69Wen di savant girl si am, e kon dey tell di pipol wey stand der sey, “Dis man dey among dem.” 70But e deny again.
Small time, di pipol wey stand for korna kon tell Pita, “True-true, yu dey among dem, bikos na Galilee yu from kom.”
71Pita kon bigin curse and swear sey. “I nor know dis man wey una dey tok about so o-o!”
72At wons, fawol kon do, “Kukuruku!” di sekond time. So Pita kon remember wetin Jesus tell am: “Before fawol go do ‘Kukuruku!’ two times, yu go deny mi three times.” Den Pita kon bigin kry well-well.
Currently Selected:
Mark 14: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: